Latest on new minimum wage as Nigerians still dey wait for labour unions and FG agreement

Labour union leaders and Bola Tinubu

Wia dis foto come from, NLC/ASIWAJU BOLA AHMED TINUBU

Read am in 4 mins

President Bola Tinubu no reach any final agreement wit di organised labour unions on top new minimum wage.

President of di Nigeria Labour Congress (NLC) Joe Ajaero, President of di Trade Union Congress Fesuts Osifo plus dia respective teams bin hold one ogbonge meeting wit di president on Thursday, 11 June, wit di expectation say di president go declare a new minimum wage for Nigeria.

But dat no happun.

However, afta di meeting, di minister of information Mohammed Idris wey follow tori pipo tok, say di issue na still work in progress and di meeting na continuation of di president regular consultation to reach new minimum wage wey go work for Nigeria.

Before di meeting, labour bin insist on N250,000 as new minimum wage, while di organised private sector and di goment team dey reason N62,000.

Oga Idris tok say during di meeting, di organised labour bin ask di goment to give dem one week to consult further and dem don allow dem. E say dem go come back afta one week.

“We go come back afta one week and we hope say at di end of di day, we go get something good for all Nigerians. Dis na step in di right direction and we hope say by next week, we go get something wey all Nigerians go agree wit.” Oga Idris tok.

Di issue of di national minimum wage wey don dey go on for months still neva dey concluded as labour unions and di federal goment neva come to agreement.

Na 62,000 naira tripartite committee on di new minimum wage bin propose while organised labour insist on 250,000 naira.

Di latest na di Nigeria Labour Congress (NLC) and di Trade Union Congress (TUC) rejection of di proposal by di Southern Governors’ Forum to decentralise minimum wage negotiations to state goments.

According to di organised labour, di proposal na threat to workers and di economy.

NLC yarn for one statement on Friday, 28 June by dia Head of Information and Public Affairs Benson Upah say to allow states to determine dia minimum wages “threaten di welfare of Nigerian workers and di national economy“.

“Dis notion no only dey dictatorial but also undermine di veri essence as well as di model adopted for creating a national minimum wage for Nigeria,” di statement tok.

Southern Governor’s Forum wan pay wetin dem fit afford

For one meeting earlier dis week, di Southern Governors’ Forum say di minimum wage no suppose dey uniform.

Dem say states suppose pay wetin dem fit afford.

“Di Forum discuss di minimum wage issues wey labour bin demand and unanimously agree say di minimum wage gatz dey reflective of di cost of living and ability to pay, and each State gatz dey allowed to negotiate dia minimum wage,” di governors tok.

How goment propose 62,000 naira as labour insist 250,000 naira minimum wage

Labour unions for dia Democracy Day statement say dem no dey back down on dia 250,000 naira new minimum wage proposal.

"Our demand still remain 250,000 naira only and dem neva give us any compelling reasons to change dis position during di tripartite negotiation process."

Both goment and labour dey propose different amount for di new minimum wage.

Nigeria goment say dem and di Organised Private Sector don agree on 62,000 naira ($41, £32) minimum wage for Nigeria workers.

For inside one statement, di Tripartite Committee on Minimum wage wey don dey meet since to discuss about di new minimum wage mata make recommendations afta dia meeting.

According to di statement, goment say dem don critically torchlight di National Minimum Wage and dem use "all necessary parameters".

Dem add say dem also apply social, economic and political considerations, relevant International Labour Organisations, Conventions and international best practices bifor di committee agree on di 62,000 naira new minimum wage.

NLC and TUC dey demand for new minimum wage even bifor President Bola Tinubu enta office for 29 May, 2023.

Oda tins goment consider as dem propose 62,000 naira as new minimum wage

According to di statement wey di Tripartite Committee release, dem tok say true true time don reach for "upward review of di present National Minimum Wage" wey be 30,000 naira since 2019.

Dem also agree say di advantages of di upward review of di National Minimum Wage plenty pass di disadvantages.

"Therefore, di Committee dey kindly invite presido to note say di Committee adopt di motion as di proposal of 62,000 naira per month as di new National Minimum Wage afta dem consider all oda factors".

Dem also tell President Bola Tinubu to "note say di organised labour dey insist on 250,000 naira per month".

"Finally di Committee hereby present 62,000 naira per month as agreed by goment and Organised Private Sector (OPS) wit policy incentives and oda conditions wey di States and di Organised Private Sector make.

Dem also present di 250,000 naira per month wey di organised labour dey recommend as di new National Minimum Wage make President Bola Tinubu look into am.