Uefa launch fresh investigation into allegations against Premier League referee David Coote

Wia dis foto come from, Getty Images
Union of European Football Associations don appoint ethics and disciplinary inspector to investigate Premier League referee David Coote.
Dis na afta one video allegedly show as im dey allegedly suck in wetin be like white powder during Euro 2024.
All dis dey happun afta PGMOL (Professional Game Match Officials Limited) tok say dem go take di new allegations around Coote "very seriously."
PGMOL tok-tok pesin say "we dey aware of di allegations and we dey take dem very seriously.
"David Coote remain suspended pending full investigation.
"David welfare kontinu to be of utmost importance to us and we dey committed to provide am wit di ongoing necessary support e need through dis period. We no dey in position to comment any further at dis stage."
Earlier, dem suspend di 42-year-old man from im job based on di video wia e allegedly yab former Liverpool manager Jurgen Klopp.
Uefa dey also investigate Coote comments about Jurgen Klopp.
End of Di one wey oda users dey read well well
On Wednesday, di Sun newspaper publish foto wey dey tok say dem take during di summer European Championship, alleging say e show Coote breathe in white powder through rolled up US bank note. All dis na allegation and Coote neva comment on dem.
Di Sun say dem bin send Coote fotos to one friend on more dan one occasion during di tournament.
BBC neva verify di video or fotos independently, but dem don reach out to Coote for comment.
Uefa say dem don launch investigation into potential violation of dia disciplinary regulations wit "ethics and disciplinary inspector appointed".
Di European governing body tok say demdon withdraw Coote from international commitment dis week and add: "Di Uefa Referees Committee immediately suspend David Coote until further notice on 11 November - in advance of di upcoming round of Uefa matches - wen e become aware of im inappropriate behaviour."
Dem bin suspend Coote ova one video wia im allegedly yab Liverpool and di club former manager Jurgen Klopp, di video don circulate ontop social media.
Refereeing body PGMOL say di suspension dey come into force wit immediate effect and dem still dey investigate di matta.
One source tell di BBC say PGMOL inquiry dey treat di video as real.

Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin happun against Burnley?
Wit dia first Premier League title secured, Liverpool aim for July 2020 na to become di first club to win evri single home game during di course of di season.
Di Reds dey on 24-match winning run for Anfield, wey don give dem 25-point lead ova Pep Guardiola Manchester City.
In addition, Klopp side dey hope to become di second team to amass 100 points during 38-game Premier League season, matching Manchester City achievement in di 2017-18 campaign.
Andrew Robertson give Liverpool di lead against di Clarets befor Jay Rodriguez equalise to give di visitors share of dia game.
At full-time, Klopp appear to argue wit Coote and im officials on di field.
"Di referee let lot of challenges go so e dey clear say if dat ball come into di box e dey dangerous. Burnley do wetin dem sabi and I salute dat," Klopp tok afta di match.
"We dey vex wit di referee but we need to criticise ourselves first for not finishing di game."
Liverpool lose dia next fixture against Arsenal, wey end dia hope of reaching 100 points.
Wetin be Coote refereeing stats?
According to appearance data from football website Transfermarkt, Coote don referee 112 Premier League matches, including three Liverpool games.
E don referee Liverpool five times in cup games.
Di three Liverpool League games as referee:
July 2020, di 1-1 draw wit Burnley.
March 2024, wen Liverpool beat Brighton 2-1
November 2024, Saturday 2-0 win ova Aston Villa
As one of PGMOL most highly-rated VAR officials, Coote don do VAR for 64 Premier League matches, 11 of dem involve Liverpool, di first na for September 2019.
In October 2020, Coote na di VAR wen Liverpool draw 2-2 wit Everton and Klopp complain about di decision say dem no go send off Jordan Pickford for challenge on Virgil van Dijk, as well as stop-time goal from Jordan Henderson disallowed for offside.
Liverpool ask di Premier League to review di VAR decisions.
Dem no appoint Coote as di VAR of Liverpool Premier League match until September 2023, di first of seven Liverpool Premier League matches as VAR last season.














