How tins take reach wia Fubara dissolve im cabinet?

Wia dis foto come from, RSGH Media
Governor Siminalayi Fubara on Thursday 12 February 2026 dissolve di Rivers State Executive Council - e dismiss all di commissioners and special advisers.
Dis move officials say na way to bring all di different factions of di govment togeda afta di settlement between di govnor and di FCT Minister Nyesom Wike.
Di decision wey take immediate effect, dey inside statement wey di tok-tok pesin Onwuka Nzeshi sign.
Dis dissolution affect di eight-member executive council wey bin remain in office afta di state of emergency wey President Tinubu bin declare for di State and di special advisers wey di govnor bin appoint to work wit am.
How di mata reach dis point?
Di dissolution dey come 48 hours afta Minister of di Federal Capital Territory (FCT), Nyesom Wike, confam di reconciliation efforts wey aim to resolve di political crisis for di state.
Di minister say President Bola Tinubu meet wit key political actors from Rivers State, including govnor Fubara for anoda attempt to reduce tensions for di power struggle for di state.
Di closed-door meeting wey hold for di Presidential Villa, also dey attended by oda Rivers leaders.
Tori be say President Tinubu urge both men to set aside dia differences and work togeda for di interest of peace and stability for Rivers State.
One of di understandings dem reach na di immediate dissolution of the state executive council to allow for di formation of a more representative cabinet.
Until now, di political balance of power for di state dey side di Wike camp, wey currently dey control all 23 local govment councils and 27 of di 32 seats for di Rivers State House of Assembly, as well as most boards, agencies, and parastatals.
Governor Fubara influence within di executive mostly dey limited to di eight commissioners wey bin still retain dia office after di declaration of a state of emergency for March 2025.
Efforts by di govnor to submit a fresh list of commissioners and present di 2026 budget bin repeatedly dey blocked by di pro-Wike lawmakers.
Dis later form part of di allegations wey di State Assembly cite for dia impeachment proceedings against di Govnor and im deputy, Ngozi Nma Odu.
Since e assume office for 2023, Govnor Fubara don face three impeachment attempts, wit di most recent one for early 2026. All no succeed following presidential intervention.
In line wih di Abuja agreement, tori be say Wike don direct di lawmakers wey dey loyal to am to drop any further impeachment plans and to begin to work wit di govnor and dis dey expected to ease tensions between di executive and di legislature.
As an initial step to implement di accord, governor Fubara don instruct di dismiss commissioners and advisers to hand over to permanent secretaries or di most senior directors for dia respective ministries.
Di govnor dey expected to submit a new list of commissioner nominees to di House of Assembly for screening and confamation, along wit a request for di approval of special advisers.
Some of di dismissed officials also dey under consideration for possible reappointment.
Meanwhile, di lawmakers case for di Court of Appeal on di impeachment of di Govnor and im deputy still dey, weda or not dem go follow through to withdraw di mata still remain to be seen.










