Wetin we know about Kate cancer diagnosis

Di Princess of Wales siddon on bench

Wia dis foto come from, BBC Studios

Wetin we call dis foto, Di Princess of Wales show for one video message wia she announce say she dey undergo cancer treatment

Di Princess of Wales say she dey for di early stages of treatment afta dem see cancer for her tests.

For one video statement, Catherine say e come as a "huge shock" afta an "incredibly tough couple of months".

But she send positive message, say: "I dey well and dey get stronger evri day."

Kensington Palace neva release di details of di cancer, but dem tok say dem dey confident say di princess go make full recovery.

Di princess statement explain say wen she bin do abdominal surgery for January, e no show say she get any cancer.

"However tests afta di operation see say cancer bin dey present. My medical team therefore advise say make I undergo a course of preventative chemotherapy and now I dey di early stages of dat treatment," di princess tok.

Wetin we call dis Video, Full video message from Catherine, di Princess of Wales

She say she dey tink of all dose wey dey affected by cancer, and add say: "For evri one wey dey face dis disease, in whatever form, please no lose faith or hope. You no dey alone."

Catherine say recovery from her surgery for January, for condition wey dem neva reveal, bin take time and di priority now na to reassure her family.

"William and I dey do evriin we fit to process and manage dis privately for di sake of our young family."

Di princess add: "E take us time to explain evritin to George, Charlotte and Louis for way wey dey appropriate for dem, and to reassure dem say I go dey ok."

She say di family now need "some time, space and privacy".

Catherine and Prince William now no dey expected to appear wit di Royal Family on Easter Sunday, and dem no go return early to official duties for di princess.

Di palace also tok say Prince William sudden absence from one memorial service for late February na becos of di discovery of Catherine cancer diagnosis.

Di couple don face serious public speculation and social media bin go alive sake of her health, since her operation for January. She neva attend any official events since Christmas.

Wetin we know about Kate cancer diagnosis?

Catherine, Princess of Wales, tok say she dey treat cancer wey dem discover afta one major abdominal surgery. She start preventative chemotherapy for late February.

Wen dem find di cancer?

Di princess undergo surgery for January. Di palace no tok about di details at di time but dem tok say di procedure dey successful and her condition bin "no dey cancer-related".

Her video message tok say di tests wey dem carry out afta di operation find cancer present.

Wetin be di type of cancer wey di princess get?

Kensington Palace neva tok about di type of cancer wey she get.

One tok-tok pesin say: "We no go share any further private medical information. Di princess get right to medical privacy as we all do."

Wetin be preventative chemotherapy?

Catherine tok say her medical team advise am to undergo "preventative chemotherapy" and she dey in di early stages of dis treatment.

Chemotherapy na catch-all term for medication to kill cancer cells - dem fit give pesin as drip or in pill form.

Prof Andrew Beggs, one consultant colorectal surgeon, tok say: "Preventive chemotherapy na afta surgery dem dey give am to reduce di risk of di cancer coming back in di future."

How much you need and how often depend on di type of cancer and how e dey grow.

How doctors take find di cancer?

Afta di surgery for January, wey Kensington Palace tok say e dey successful, doctors perform tests wey reveal cancer dey present.

Commonly, tissue dem remove during surgery, dem go send am to lab for analysis and to see wetin be di cells.

She dey receive treatment privately or on di NHS?

Catherine original operation take place for di London Clinic, one private facility.

Di Palace neva comment on wia she dey receive care now. For her video message, Catherine thank di "fantastic medical team" wey don dey treat her.

Wetin be cancer?

Cancer dey occur wen cells for one specific part of di body divide in uncontrolled way.

Untreated, dis cells fit potentially spread to oda tissues in di body, including organs, wey we know as secondary or metastatic cancer.

How many pipo get cancer?

For UK, one in two pipo dey develop some kind of cancer during dia lifetime.

More dan 200 different types of cancer dey - di most common one for UK na breast, lung, prostate and bowel, according to di NHS UK website.

Each cancer dey diagnosed and treated in one particular way.

Anyone fit develop cancer, but di risk dey go up di older we become becos damage cells get more time to build up.

Most cases of cancer dey among pipo aged 50 and ova. For UK, one-third of all cases dey for pipo aged 75 and ova.

Survival from cancer don double in di last 50 years.

Wetin you fit do if you think say you get cancer?

If you notice something wey no dey normal for you, see doctor.

Dat fit include:

  • unexplained bleeding or pain
  • an unusual lump or swelling
  • unexplained tiredness and weight loss
  • persistent cough

Di symptoms you dey experience fit no be cancer, but e dey important to get am checked.

Finding cancer early fit make am easier to treat.

Princess of Wales

Wia dis foto come from, Getty Images

For her video statement, di Princess of Wales tok about di support from her family:

"Having William by my side na great source of comfort and reassurance too.

"So as di love, support and kindness wey so many of you don show. E mean so much to both of us."

Kensington Palace tok say BBC Studios feem di video of di princess on Wednesday, di production arm of di BBC.

For one statement, BBC News say: "Along wit oda media, Kensington Palace brief BBC News on di announcement dis afternoon."

Prime Minister Rishi Sunak tok say Catherine don show "tremendous bravery" wit her statement, e wish her a "speedy recovery".

E say: "In recent weeks, she bin dey subjected to serious scrutiny and certain sections of di media around di world and on social media no treat her fairly.

"Wen e come to matas of health, like evri one else, she suppose dey afforded di privacy to focus on her treatment and be wit her loving family."