Kate admit say she edit Mother's Day picture

Catherine with Prince Louis, Princess Charlotte and Prince George

Wia dis foto come from, PRINCE OF WALES

Di Princess of Wales don apologise "for any confusion" afta she admit say she edit one Mother Day photograph of her and her children.

Dem post her statement for Kensington Palace social media afta five agencies remove am for editing concerns.

"Like many amateur photographers, I dey occasionally experiment with editing," Catherine tok.

Di picture, wey di Prince of Wales take, na di first of Catherine dem go dey release since her surgery for January.

PA, Getty Images, AFP, Associated Press (AP) and Reuters don remove di image. AP note say "inconsistency in alignment of Princess Charlotte left hand".

For her statement ontop X, formerly Twitter, Catherine say: "I want express my apologies for any confusion di family photograph we share yesterday cause. I hope everyone wey dey celebrate get a very happy Mother Day. C."

Di apology, wey dem post for social media, dey come from di official account of di Prince and Princess of Wales, but e get di personal sign off of "C", for Catherine.

She dey take responsibility for di changes to di photograph, rather dan her husband Prince William, wey take di photo, or any of di wider team around di royal couple.

Closer look at di photo

Wia dis foto come from, Prince of Wales/Kesington Palace

Wetin we call dis foto, A closer look at di image reveal say: (1) Part of Princess Charlotte sleeve dey miss, (2) Kate hand dey blurred compared with Louis jumper, (3) misaligned zip, (4) misalignment for di background and (5) blurring of Princess Charlotte knee

According to royal sources, di Princess of Wales make "minor adjustments" to di picture wey Kensington Palace post online.

Kensington Palace say dem no go reissue di original unedited photograph of Kate and her children.

We know say dem edit di photograph, but some basic information about di image no dey known - such as wen exactly dem take am, wetin dem change or weda na collage of pictures.

Di photograph show di princess siddon down, surrounded by Princess Charlotte, Prince Louis and Prince George wey wrap im arms around her.

Na di first official photo of di Princess of Wales since her abdominal surgery two months ago. Since den she don stay out of di public eye.

Dem post di image with a message from Catherine wey say: "Thank you for your kind wishes and continued support over di last two months.

"Wishing everyone a Happy Mother's Day."

Dem bin only reason di photo as "amateur, family photograph" released to mark Mother's Day, royal sources tok.

Di implication na say dis no be a piece of professional manipulation, but some tidying up of a picture wey capture a family moment.

Except say dis no be just a personal picture, dem go share am with di world, against a background wia dme go see am as an attempt to stop di speculation and conspiracy theories about Catherine, as she dey recover from one operation.

'Raising more questions'

Instead of providing answer to such rumours e don end up raising more questions.

Di photo go also lead to discussions about how media outlets suppose use images or social media clips wey dem get without any independent journalists being involved.

Although most public royal events go get professional photographers and press representatives, dis bin dey seen as a private moment, wey di family capture themselves, as di princess bin dey recover.

Di only previous photo of di princess since her operation na one paparazzi shot, wey UK news organisations bin no use because of concerns about breaches of privacy.

Previous examples of Kensington Palace putting out video footage without any external journalists being present dey, including one visit by di Princess of Wales to one "baby bank" wey dey help disadvantaged families.

Di Mother's Day image bin dey included on di front pages of several national newspapers and websites, including BBC News, and dem use am on TV news bulletins - again including BBC.

In order to use di new photo as quickly as possible, BBC bin take di one Kensington Palace use for dia social media accounts.

Di photo

Wia dis foto come from, PRINCE OF WALES/KENSINGTON PALACE

Five photo agencies remove di image over concerns say e bin dey "manipulated". The Associated Press issue a "kill notification" - industry term wey dem dey use to remove a story - late on Sunday, saying: "At closer inspection e appear say di source don manipulate di image. No replacement photo go dey sent."

Reuters say dem too bin withdraw di image "following a post-publication review" and AFP also issue a "mandatory kill notice".

Getty Images became di fourth organisation to comot di photograph. And PA tok later on Monday say dem too bin take down di image, based on say no clarification come from Kensington Palace.

Most news organisations follow dia own strict guidelines on di use of manipulated photographs, only using dem wen e dey followed by an explanation say di image don dey changed from di original.

News agencies, such as AP, therefore make a commitment to dia clients say dia photos dey accurate and no dey digitally manipulated.

AP rules only allow "minor adjustments" for certain circumstances, including cropping and toning and colour adjustments, as well as di removal of dust on camera sensors. E say changes in density, contrast, colour and saturation levels "wey substantially change di original scene" no dey acceptable.

Catherine, 42, spend 13 nights for di London Clinic, near Regent Park for central London, following di surgery.

Prince William go see im wife during her stay and she bin also dey visited by di King before e collect im own treatment dia.

Di Palace don share few details about her condition, wey don cause significant social media speculation, but dem say e no dey cancer-related.

Di team supporting di princess as she dey recover dey small and limited to those wey dey closest to her.

At di time of her stay, di Palace say di princess want her personal medical information to remain private, adding say she wan to "maintain as much normality for her children as possible".

Di Palace say dem go only provide updates on her recovery wen significant new information dey to share.