Dem don detect cancer for UK King Charles body

Wia dis foto come from, PA
Di United Kingdom King Charles don dey diagnosed wit a form of cancer.
Na di Buckingham Palace tok dis one
No be prostate cancer, but dem discover am during im recent treatment for one enlarged prostate.
Dem neva reveal di kain cancer wey e be, but according to one palace statement di King begin "regular treatments" on Monday.
Di King, 75, go step back from im public engagements and Queen Camilla and Prince William go help to stand in for am during di period wey im dey receive treatment.
Dem neva share any further details on di stage of cancer.
But Buckingham Palace say di King "remain wholly positive about im treatment and im dey look forward to returning to full public duty as soon as possible".
Although im go pause im public events, di King go kontinu wit im constitutional role as head of state.
Im attend one church service for Sandringham on Sunday, wia e wave to crowds.
Im bin get prostate procedure for one private London hospital more dan a week ago.
Di King choose to go public about im prostate treatment, wit di aim of encouraging more men to dey do prostate checks.
Im bin dey delighted to dey raise awareness about di issue, wit di NHS website reporting increase in issues about prostate conditions.
E dey understood say no be prostate cancer, but dem discover am during im recent treatment for an enlarged prostate.
Im go dey undergo chemotherapy but e dey believed say dem don catch di cancer for early stage.









