Why teachers, Africa Games volunteers and oda groups dey protest for Ghana

Volunteers say organizers promise dem stipends

Wia dis foto come from, Getty Images

Dis na week of agitation for Ghana.

Various groups don dey fire di goment ova dia service conditions and entitlements.

E dey come at a time wey di kontri dey try to bounce back from wetin sabi pipo describe as economic crisis.

Di minority for Ghana parliament dey put fire under di goment say dem dey spend plenti moni on tins like di national cathedral wey neva be priority.

Already dem don spend $58m for di project wey neva pass di foundation stage.

But di president say dem go still build di project as “sacrifice to God.”

Dis don dey happun at a time di kontri dey under $3bn IMF programme.

Di fund alreadi disburse $1.2m of di moni to di bank of Ghana in two tranches.

But various sectors for di economy dey complain, wia agitation and protest dey continue.

1. Teachers dey on strike

Three teacher unions wey be di Ghana National Association of Teachers (Gnat), National Association of Graduate Teachers (Nagrat) and di Coalition of Concerned Teachers (CCT) don declare strike for 20 March.

Oga for di association of teachers, Rev Isaac Owusu don tok say di education ministry fail to “address pressing issues wey dey face teachers.”

Im tok for one press conference say “goment fail to re-negotiate dia collective agreement afta di current one expire for 2023.”

Dis agreement “go deal wit issues of allowance for teachers for rural areas and moni for rent.”

Di teacher unions also tok say goment gatz complete “di distribution of laptop to all teachers.”

For 26 March, some of di teachers wia wear red shirt and armbands don storm di education ministry.

Na so di ministry and oda agencies tok say make dem call off di strike as goment deal wit dia issues.

Di national Labour commission, di education minister and di fair wages and salaries commission meet wit di teachers wey dem promise to fix dia issues.

But di group say unless all dia issues don solve, dem neva go go back to di class room.

Alreadi students for basic schools for di kontri dey complain say di absence of di teachers go affect dia preparation for di basic education certificate examination (BECE).

Di teacher unions dey strike since 20 March

Wia dis foto come from, Screengrab

2. Africa Games volunteers vex ova unpaid stipends

Volunteers wey help di local organising committee for di Africa Games wey just end, for 26 March agitate say make di sports ministry pay dem dia stipends.

Di volunteers protest for di games village ova di moni as security officials try to evict dem from di accommodation facility.

Dem tok say unless di sports ministry pay di moni wia dem promise, dem neva go leave di place.

Na so policemen fire warning shot to calm di pipo for dia.

Di volunteers explain say authorities don promise dem $190 (GHC 2,500) each ahead of di games, wia some of di moni na for transport.

But days afta di games, dem neva see di moni.

One of dem, Nana Osei tok BBC News Pidgin say im no go fit travel back to where im comot.

“Dem say dem go give we dis moni since. Now di games end, wia dem no want pay we. How I go get moni for transport?”

Afta di confrontation wit di police, oga wey dey in charge of di volunteers, Juliana Addo-Yobo don tok say di sports ministry “dey work to settle all di volunteers.”

Im tok say “we try to hold on to see if we fit get enough moni to give dem at least for transportation to go to dia destinations but we neva get di moni for di 23 March wen di games end.”

But di ministry dey release moni to give to dem.

Despite dis, di volunteers say unless dem see di moni, dem no go move from di games village.

3. Investment holders dey protest for Bank of Ghana

Pipo wey dia investment lock for various financial institutions wia dey licensed by di Bank of Ghana dey protest say make di central bank pay dia moni.

Di group, investment holders forum say dem put dia moni for dis institutions becos na di bank of Ghana don license dem.

But dem neva receive dia returns wia dia moni also don lock.

For one statement, convenor of di forum, Dr Adu Antwi tok say dem dey march to di Bank of Ghana premises to “press home dia demand say make di central bank resolve dia issue.”

Dem tok say dem also go meet wit di central bank govnor, Dr Ernest Addison and di ministry of finance ova dia petition.

4. National food suppliers dey demand dia one year arrears

Di food suppliers wey dey provide foodstuff to senior high schools for di kontri dey cry ova dia one-year unpaid arrears.

Dem say dem no fit to dey continue to supply di food wit goment failing to pay dem.

Tok tok pesin for di suppliers, Kwaku Amedume for one press release say, dem find some shakara for di payment method.

“Di pipo wey dey di national food buffer stock company neva receive payment since February 2023, but some suppliers wey dey directly under di education ministry don receive payment," Amedume tok.

Amedume tok say “we suspect say dem wan frustrate di activities of di buffer stock company wey don dey affect us".

Di suppliers say dem dey expect to receive dia moni within two weeks.

Dem tok for dia press release say “we no go sit down make dem cheat us evri day.”