Tears as dem lay singer Onyeka Onwenu to rest for Lagos

Wia dis foto come from, @onyekaonwenu/Instagram
Family of Nigerian singer Onyeka Onwenu don lay am to rest on Friday, 30 August for Lagos, southwest Nigeria.
Onyeka wey also be songwriter, actor, journalist, activist, and politician, die at di age of 72.
Her funeral service hold for di Fountain of Life Church Ilupeju and burial hold for one private vault for Ikoyi Cemetery.
Wit tears and tributes, dem lay di bodi of late Onyeka to rest for Lagos as families and friends gada to pay dia last respect to her.
Wen di singer die, President Bola Tinubu bin extend im condolences to di family of di late Onyeka Onwenu.
According to one statement wey Ajuri Ngelale, Tinubu tok-tok pesin release, di president remember many creative work of di late musical icon in promoting public good.
"President Tinubu celebrate di life of di versatile artiste wey apply herself to di whole gamut of artistic enterprise and expression, bringing joy and laughter to many.
"Di President condole wit di entertainment industry, di Imo State Government, and di numerous fans of di departed star over dis immeasurable loss," di statement tok.

How di burial take waka
Early Friday morning, di bodi of late Onwenu arrive for di Fountain of Life Church for Lagos.
Wit families and friends, di bodi enta di church premises wit di undertaker men who dressed in di igbo traditional attire.
At around 10am, di bodi of late Onwenu enta as di choir of di church bin dey sing processional hymn.
Di pastors do prayers for di family and ask make di bodi of Onwenu enta eternal safe journey.
Afta di service of songs for church, dem carry di bodi of late Onyeka go di cemetery wia dem bury her bodi.
Dem carry her ontop horse wey ride her casket reach di cemetery wia dem lower her bodi enta di grave.
Her sons pour sand as part of dia last respect for her.
One emotional tin wey happun na wen one of im sons carry her mama bible put for her casket as dem lower am enta di grave.
Some family members bin shed tears while some dey very sad wit heavy eyes.
Tributes to late Onyeka Onwenu
Abia state govor, Alex Otti describe di late Onwenu an as outstanding singer wey emerge from Africa and she be blessing for to many generations.
"Onyeka Onwenu na one of di most outstanding songsters to emerge from di African continent, blessing several generations wit countless soul lyrics, and most importantly, teaching us important lessons for life, love and service."
"Her long life for di industry, and relevance, even at her hour of departure, point us to di great gift and talent wey she really be," Otti tok.
Otti add, "thank you for touching lives, for being true and brave, and for teaching us say our lives fit only be full and impactful wen we make di most of di abilities and resources wey dey available to us."
Presidential candidate of di Labour party for di 2023 election, Peter Obi describe di late singer as an impactful soul.
"God give a wonderful and impactful soul to Nigeria. She try to show love and service to humanity."
Obi say di late Onyeka live a life of love and giving and she dey dey part of everitin wey get progress.













