Angelina Jolie and Brad Pitt reach divorce deal after eight year battle

Angelina Jolie and Brad Pitt

Wia dis foto come from, Reuters

Read am in 3 mins

Hollywood stars Angelina Jolie and Brad Pitt don reach divorce settlement after eight years, her lawyer don tell di media.

No immediate comment from Pitt attorney wen tori pipo approach dem for comment, Associated Press report.

Di couple - wey pipo sabi as "Brangelina" by fans - marry for 2014 and dem get six children.

Jolie file for divorce for 2016, she cite "irreconcilable differences", days after one private jet flight wia she claim say Pitt bin dey abusive to her and dia children. After one FBI probe to chook eye for di incident, dem no charge Pitt and e don deny di claims.

Di two bin dey di middle of one bitter child custody battle months following di announcement, but di couple reach agreement and judge award joint custody of di children to both parents for 2021.

While Pitt and Jolie sign off on di divorce settlement paperwork on Monday according to reports, di couple still dey in a legal battle over one chateau - house- and vineyard for di south of France.

For 2022, Pitt sue Jolie for selling her stake for di French vineyard and chateau dem buy togeda for 2008.

Di couple bin marry dia.

According to legal documents wey PA news agency bin get at di time, e bin dey alleged say Jolie sell her share of Chateau Miraval to one Luxembourg-based spirits manufacturer wey dey controlled by Russian oligarch Yuri Shefler, without Pitt knowledge.

Jolie and her representatives never publicly comment on di vineyard lawsuit.

Di couple bin meet ontop di set of di 2005 film Mr and Mrs Smith and bin be one of Hollywood most high-profile couples at one time.

Di marriage na Pitt second - e bin wed Friends star Jennifer Aniston before - and Jolie third one after actors Billy Bob Thornton and Jonny Lee Miller.

Jolie don act inside in Lara Croft: Tomb Raider, Changeling and Girl, Interrupted. Her latest film na biopic, titled Maria, about opera singer Maria Callas.

Pitt filmography include Fight Club, Once Upon a Time in Hollywood and Twelve Monkeys. Dem don spot am dis year for Silverstone filming im Formula One movie titled F1 wia e go play veteran driver Sonny Hayes.