Full list of players wey don withdraw from Ghana Black Stars squad ahead of 2025 Afcon qualifiers

Wia dis foto come from, GFA/GETTY
Di Ghana Black Stars dey under more pressure ahead of dia two crucial Afcon qualifiers wey go happun if dem go play for Morocco or not.
Eight of di key players wey coach Otto Addo don invite for di two final group F games - Angola on 15 November and Niger on 18 November, don withdraw from di squad.
Dis na afta di coach tok say im no go invite Arsenal midfielder Thomas Partey for di games even though di player tok say im wan play di games.
Di Arsenal midfielder wey be captain of di team miss di last round of games as di English club tok say make im no go international duty sake of wetin dey tok say na “physical concerns”.
But managers of di national team tok say dem neva dey convinced by di excuse as “di player no make imserf available for follow-up assessment” at dat time.
For one press conference Otto Addo tok say “to play for di national team, you gat to be disciplined, you gat to be role model wey you gat to show performance
Why 8 players withdraw from di squad

Wia dis foto come from, GFA/FACEBOOK
Now eight more players don give different reasons why dem no fit play di qualifiers.
Bournemouth striker Antoine Semenyo and Athletic Bilbao forward Inaki Williams both comot di 25-man squad sake of injury
Di Ghana football association inside one statement on Monday, give details about dis players and wetin dey make dem dey withdraw.
Inaki Williams: Im get hamstring injury on 7 November – wia im no fit train since then
Tariq Lamptey: Im dey recover for im club Brighton afta “calf discomfort” wey don become worse last week.
Jonas Adjetey: Di FC Basel defender don dey recover from one injury bifor im get setback for dia last league game on Saturday 9 November.
Jerome Opoku: Di defender also bin get wetin dey call “chronic back pain” wey don become worse for Istanbul Basaksehir dia game vs Besiktas on Sunday 10 November
Antoine Semenyo: Di Bournemouth striker wey dey on top form get injury for “patella tendon” sake of im play plenty games. Na so di club medical team advice say make im take small break for dis time make tendon specialist treat am.
Alexander Djiku: Fenerbahçe don substitute Djiku for dia game on Sunday as dey tok say im existing hamstring wey don scatter again
Ibrahim Osman: Di Feyenoord winger don get hamstring injury for dia last club game na so di coach don comot am for di game at halftime.
Joseph Painstil: For di LA Galaxy forward, di GFA tok say di reason why im withdraw from di squad na “personal”.
Wetin fans dey tok
Some soccer fans and sabi pipo say make di coach invite local-based players make dem play those two games.
“Di players sabi say dem neva go qualify for di Afcon so dem no wan waste dia time,” one football fan Joshua Agomor tok BBC Pidgin. Im also don dey suspect say na sabotage.
“Na easy tin say players go sabotage dia coach – I tink say di players don decide to boycott di game afta di coach drop Thomas Partey for di squad.”
Robert Temperature Kuegbesika tink say dis na di time for local players.
“Di local players gat energy and vim to perform wit small motivation wey most of dem also sabi di African terrain well well.”
“Also if di fans no go get high expectations wey go put pressure for dia top.”
Angola already qualify for di Afcon from group F wit 12 points from 4 games.
Sudan wey dia coach na former Black Stars player and coach Kwesi Appiah dey second on di table wit 7 points.
Ghana dey third wit only 2 points as Niger dey bottom of di table wit one point.
But for coach Otto Addo, di blackstars still get slim chance.
“E neva dey over. Mathematically, we still get chance wey we go do everitin in our power to keep dis chance alive.”
Otto Addo dey under pressure afta recent poor results, as some sabi pipo and fans already say make di Ghana football association sack am.

Wia dis foto come from, GFA/FACEBOOK
'Dis mass withdrawals na global problem'
But wetin di plenty withdrawals from di squad for dis two games vs Angola and Niger mean for di team?
Dat be di question BBC Pidgin ask one ogbonge football sabi pesin – Gary Al-Smith, wey im tok say “wit every first-choice player wey withdraw from di team, na so di kontri chance say dey go qualify for di Afcon dey fade.”
As to whether dis tins wey don dey happun at dis time na issue of lack of commitment by some of di players, Gary explain say “na debate wey don dey go on; some feel say management of di team no dey do enof to create di right conditions for di players wey go make dey give dia 100%.”
“Some pipo too dey believe say players no dey di right psychological condition sake of tins like poor pitch, logistics wahala and even di lack of protection from fans wey don dey over critical of di players.”

Wia dis foto come from, GFA/FACEBOOK
Some fans and oda pipo bin dey tok say some of di players no dey care to sacrifice for di shirt.
Gary believe say di problem be a mix of everitin – na so everibodi gat to dey accountable if di kontri go succeed.
Im also explain to BBC Pidgin say wit dis kind withdrawal of ogbonge players from dia national team duty, na global wahala.
“No be just Ghana dey face dis kind tin, as di international calendar don dey become packed, top players around di would dey arrange wit dia clubs wey dey go make excuse say dey no fit go dia kontris.”
Im add say “if di football pipo no fix dis tins, we fit expect Ghana and oda national teams wey dey various stages of growth, to dey suffer dis kind withdrawals.”









