Woman wey dem jail for 20 years say she kill her children free afta dem cancel her judgement
One woman wey dem bin dey call "Australia worst mother" don see di judgement wey find am guilty say she kill her four children dey cancelled.
Di New South Wales Supreme Court rule on Thursday say di evidence wey dem bin first use send Kathleen Folbigg go prison "no dey reliable".
Di state goment free di 56-year-old for June, afta she spend 20 years for prison.
Folbigg welcome di latest news but say dem bin “ignore And dismiss” proof of her innocence for many years.
"Di system bin prefer to blame me instead of to accept say sometimes children fit and dem dey die suddenly and unexpectedly and heartbreakingly," she tok outside court on Thursday.
Folbigg case na wetin some dey describe as one of Australia greatest miscarriages of justice.
Di case concern di death of her four small pikin dem Caleb, Patrick, Sarah, and Laura - each of dem die suddenly between 1989 and 1999, between di age of 19 days and 18 months.
Goment lawyers during her court case say she choke dem.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di case bin rely on circumstantial evidence, wey dem get from Folbigg diaries – wey psychologists or psychiatrists no ever examine - to paint her as unstable mother, wey dey quick vex.

Wia dis foto come from, Reuters
For 2003, court send her go 40 years for prison for di murder of Sarah, Patrick and Laura, and di manslaughter of Caleb.
Dem later downgrade am to 30 years on appeal, but Folbigg lost many legal challenges wey try turn her convictions.
Earlier dis year, one landmark inquiry into her case conclude say dem get reasonable doubt say she guilty, due to scientific findings say her pikin dem fit don die of natural causes becos of one seriously rare gene mutations.
And na dat "substantial and extensive body" of new evidence wey make dem clear Folbigg of all charges on Thursday, Chief Justice Andrew Bell say.
Folbigg legal team confam say dem go ask for compensation on her behalf, but im no tok pass dat one.
Her case don capture di attention of di whole world and dis don lead to accusations say Australia legal system dey slow to respond to advanced science.
"I dey grateful say updated science and genetics don give me ansa to how my children take die," Folbigg say.
"However, even for 1999, we bin get legal ansa to prove my innocence.
"[Goment lawyers] turn my words upsidedown and use dem against me... I hope say no-one else go ever suffer wetin I suffer."















