Death toll for Dominican Republic nightclub collapse rise to 124
- Author, Vanessa Buschschlüter
- Role, BBC News
- Read am in 4 mins
Hundreds of rescue workers for Dominican Republic don search through di night for survivors for roof collapse for one nightclub in di capital, Santo Domingo.
At least 124 pipo die and more dan 150 pipo don injure for di incident wey happun just bifor 01:00 local time (05:00 GMT) on Tuesday at di Jet Set club, officials tok.
Hundreds of guests bin dey inside di popular venue attending one concert by merengue singer Rubby Pérez.
Pérez, as well as former Major League Baseball player Octavio Dotel, and one provincial govnor, dey among pipo wey dem confam say dem don die.
Mobile phone foto record inside di club, wey BBC verify show Pérez on stage dey sing while dem hear di man as e dey tok.
"Somtin fall from di ceiling," di man wey dey record tok, while im finger dey point towards di roof.
For di foto, Pérez dey look at di place di man point.
Less dan 30 seconds later, we hear one noise and di recording go black while one woman dey shout "Dad, wetin happun to you?

Wia dis foto come from, Reuters
E no dey clear how many pipo exactly dey inside di popular venue but estimates range between 500 and 1,000 pipo.
Emergency workers don demolish one of di walls of di club to beta reach pipo wey dey under ground.
Relatives desperate for news of dia missing loved ones don hold vigils for di scene.
Among dem na Pérez's daughter Zulinka, wey dey back di band singers
She describe how she bin dey on stage, singing wit her papa wen di tragedy happun.
Zulinka tok say na her husband save her as e protect her wit im bodi wen di roof collapse. E tell her say she need to comot "to dey dia for our son".
She manage to crawl out from under di rubble and her husband also make am out alive.
Her 69-year-old papa, however, remain trapped for hours.
According to Zulinka, im survive di collapse and manage to guide emergency workers to im location.
"Dem find am singing, e start to sing so dem go hear am," she tell local media.
But around 17:00 local time, more dan 16 hours afta di tragedy happun, Zulinka inform rescue workers for di scene say her papa don die bifor dem fit free am.
Im manager later confam say e don die.

Wia dis foto come from, Reuters
Di director of Emergency Operations Centre (COE), Juan Manuel Méndez, tok say im still get hope say many of di pipo wey dey under di collapsed roof still dey alive.
Jet Set na one popular nightclub for Santo Domingo wey dey always host dance music concert evri Monday night. Politicians, athletes and oda important pipo bin dey dia wen di wahala happun.
Di govnor of Monte Cristi, Nelsy Cruz, also dey among di victims, President Luis Abinader tok. She be sister of di former baseball player Nelson Cruz wey be di Major League Baseball All-Star.
Dotel start im baseball career wit New York Mets for 1999, and later play for teams like Houston Astros, Oakland A's, New York Yankees, Chicago White Sox and Detroit Tigers until 2013.
One video wey dem say dem record inside di club show pipo wey dey sidon for table near di stage, while some oda pipo dey dance for back as Rubby Pérez dey sing.
For oda phone recording wey dem share for social media, one man wey dey stand for di next stage bin tok say "somtin don fall from di ceiling", and e use im finger dey point near di roof.
President Abinader don express im condolences to di families wey di kasala affect











