'Pipo no believe say grapes fit grow for Nigeria'
- Author, Mansur Abubakar
- Role, Writer
- Reporting from, Kano
Man wey get one of di biggest grape farms for Nigeria, Abdullahi Dalhatu, tell BBC Pidgin say before before pipo dey look grape as foreign fruit wey no fit grow for di kontri.
Dalhatu wey start im farm for Kaduna state, northwest Nigeria many years ago yarn say today, supermarkets and buyers even prefer im grapes to foreign ones becos e "sweet pass."
"Na just two years ago we start grape farming but pipo dey rush us now, Nigeria dey blessed wit favourable conditions wey fit make any fruit grow."
"Wen we first start some pipo no believe say e go work but today our product dey for plenty supermarkets and shops across Nigeria."
Dalhatu dey also plant oda fruits like paw paw, jackfruit and banana.
Video of im farm go viral for social media some months ago wey make plenty pipo dey surprise say Nigeria fit grow grapes.
Di viral video make chairman of Kudan local goment for Kaduna visit im farm and promise to give all necessary support to di facility.
Im dream na to make major impact across Africa with im farm but e tok say goment support dey necessary.
Filmed and edited by Idara Monday






