Labour Party crisis and all di drama wey don happun

Labour Party leadership

Wia dis foto come from, Nigeria Labour party/X, Nenadi Usman/X

Read am in 5 mins

Labour Party wey be one of di opposition political parties for Nigeria still dey face leadership crisis.

Di latest na di two factions National Executive Council (Nec) meeting wey happun for di party.

Di faction wey Julius Abure dey lead hold dia Nec meeting on Monday 7 April, 2025 for dia national secretariat, Abuja, Nigeria capital.

Afta di meeting, di Julius Abure faction bring out ten points resolution wey im and Umar Farouk Ibrahim sign as National Chairman and National Secretary of di party.

Meanwhile, local media Tribune report say big names for di party like Peter Obi and Abia govnor Alex Otti do dia own Nec meeting on Wednesday 9 April.

Tori be say di Abure faction dey threaten to take disciplinary action against Obi and Otti sake of say dem hold dia own meeting, and Abure faction see am as breach of party regulations.

Obi, Otti visit Inec

Some Labour Party leaders march go di headquarters of di Independent National Electoral Commission (Inec) for Abuja, Nigeria capital.

Local media Channels report say na Peter Obi wey be di 2023 presidential candidate lead dem.

Di govnor of Abia State, Alex Otti, and odas joinbodi go Inec office and di Inec National Commissioner, Sam Olumekun welcome dem.

Dem tell di Inec to recognise Nenadi Usman as di party chairman.

Dis dey come afta di Supreme Court set aside di judgment of di Court of Appeal for Abuja wey bin recognise Abure as di National Chairman of Labour Party.

Foto of former Labour Party chairman

Wia dis foto come from, Labour Party

Wetin we call dis foto, Julius Abure

Di Supreme Court judgement

On Friday, 4 April, di Supreme Court bin set aside di judgement of di Court of Appeal for Abuja, di kontri capital wey recognise Julius Abure as di National Chairman of di Labour Party.

While one faction of di Labour Party tok say di ruling of di Supreme Court affirm Julius Abure as di National Chairman of di party, di oda faction wey dey loyal to di caretaker committee dey of di position say di ruling sack Abure.

One five-member panel of di Supreme Court togeda agree say di Court of Appeal no get di right to pronounce Oga Abure as di National Chairman of di Labour Party, since e know say koko of di case na about di party leadership.

Di apex court dey of di position say di issue of leadership na internal affair of a party and di courts no get authority to shook mouth for di mata.

How dis kasala take start

Di recent wahala na between Julius Abure and di only govnor wey di party get, Alex Otti of Abia State.

Na for August 2024 di main kasala start afta Otti bin offer to host one meeting of di National Executive Committee of Labour Party on 31 August to discuss di leadership crisis for di party

Oga Otti bin tell tori pipo say di party need new leadership and e go good to dissolve Abure chairmanship and appoint new caretakers for di party.

Dis tok make Alex Otti and Julius Abure no gree for each oda again as Abure reply am for press conference wia e cut warning give Alex Otti and tell am say make e focus on im leadership of Abia State and make e no chook mouth for di leadership of Labour Party.

Abure bin tok say "Assuming witout conceding say di tenure of di National Working Committee don even expire, e no be di responsibility of Dr Alex Otti as di govnor of Abia State to convene a Nec meeting to setup a caretaker committee," Abure tok.

Abure threaten dem say "di party no go hesitate to discipline any member of di party, however highly placed, wey no dey ready to obey di constitution of di party".

Abure tell Otti say LP no be party wey one man or one woman or one leader go dey control anyhow, and e suppose dey respectful to di party wey give am power after e bin don fail wit PDP and APC.

Di kasala kontinu until di mata of who be di real party chairman of LP reach Supreme Court.

Labour Party and Nigeria Labour Congress drama

Di next drama na between Labour Party and di Nigeria Labour Congress (NLC).

Di leadership of di Labour Party on Wednesday no happy wit di warning wey di labour union for Nigeria cut for dem.

Nigeria Labour Congress bin threaten Labour Party say dem go invade dia offices across di nation.

But Labour Party describe di threat as blackmail to make di faction wey Julius Abure dey lead look like di pipo wey dey find trouble or cause di kasala.

Di party tok say e make dem look bad for di eyes of di Independent National Electoral Commission (Inec) and security agencies for di kontri.

Labour Party also tok say dem go find protection from security agencies and mobilise members across di nation to resist di invasion of all dia offices across di kontri.

Dis na wetin di National Publicity Secretary of Labour Party, Obiora Ifoh tok for statement for Abuja.

Na on Tuesday wey NLC President, Joe Ajaero bin give di directive wia e ask union leaders to begin di process of mobilising dia members to prepare to invade and take ova di 36 offices and national secretariat of di Labour Party.

Meanwhile some ogbongeb pipo don comot from di party sake of di crisis.

For one interview wit Senator Ireti Kingibe wey win her seat under Labour Party, she bin tell BBC Pidgin say " time still dey for Labour Party to resolve di kasala for di pipo".

She add say e no good as pipo wey bin win seats under di party dey comot sake of di leadership crisis.

She believe say no problem wey no get solution as she hope say di mata go resolve veri soon.