Julius Abure and senator Nenadi Usman lay claim to victory afta Supreme Court judgement on LP

Nigeria Labour party Julius Abure and Nenadi Usman

Wia dis foto come from, Nigeria Labour party/X, Nenadi Usman/X

Read am in 4 mins

Different interpretations don dey on di judgement wey di Supreme Court give on di leadership of di Nigeria Labour Party.

While one faction of di Labour Party tok say di ruling of di Supreme Court affirm Julius Abure as di National leader of di party, di oda faction wey dey loyal to di caretaker committee dey of di position say di ruling sack Abure as di national chairman of di party.

On Friday, 4 April, di apex court bin set aside di judgement of di Court of Appeal for Abuja, di kontri capital wey recognise Julius Abure as di National Chairman of di party.

One five-member panel of di Supreme Court togeda agree say di Court of Appeal no get di right to pronounce Oga Abure as di national chairman of di LP, since e know say koko of di case na about di party leadership.

Di apex court dey of di position say di issue of leadership na internal affair of a party and di courts no get authority to shook mouth for di mata.

Di National Publicity Secretary of di Labour party Obiora Ifora for one statement afta di apex court judgement explain say Julius Abure remain di National Chairman of di Labour Party and dat na di position of di Supreme Court.

E say di supreme court judgment no sack Oga Abure instead e hold di judgements of di high courts and appeal court wey give di responsibility of di party structures to choose dia leaders.

"Di Supreme Court insist say di lower courts no suppose rule on di leadership of a political party. Di court therefore strike out Senator Nenadi Usman appeal for di appeal court plus di Labour Party suit for di trial court."

Oga Ifora add say di leadership of di party dey satisfied wit di judgement of di apex court wey further reaffirm Julius Abure as di national chairman of di Labour Party and di current national working committee as validly elected as dem dey duly nominated, endorsed, and ratified through di internal mechanism of di Labour Party statutory organs in line wit di party constitution.

E call on all true members of di party to obey di judgement of di apex court, and say make dem always resort to internal party mechanism in resolving party affairs make dem no all di time dey run go court.

"Na only di political parties get di powers to choose dia leaders no be di courts," Ifora tok.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 1

Meanwhile, Labour Party Caretaker Committee wey one former Minister of Finance, Madam Nenadi Usman dey head no reason am like dat.

Madam Usman for statement hail di judgement as she say dis na time to move di party forward.

"E dey important to emphasize say dis no be time to dey jubilate — victor no dey and no vanquished. Wetin mata most na our shared commitment to di ideals and aspirations of di Labour Party plus di Nigerian pipo. We must now come together, united in purpose and vision, to move di party forward."

Also one Obedient movement hope say di supreme court judgement go mark di end of di long leadership crisis within di party.

For statement wey di tok-tok pesin Obi-Datti Campaign Team Nana Kazaure issue, e say dem choose to embrace di "no victor no vanquished position, as dem recognise di contributions of Abure National Working Committee to di growth of di party and dia sacrifices especially during di 2023 election."

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 2

For January, di Court of Appeal for Abuja bin rule say Abure remain di chairman of di Labour party.

One three-member panel of di appellate court, for one judgment wey Justice Hamma Barka deliver hold say dia judgment of November 13, 2024, wey recognise Abure as national chairman, remain and no court don change am.

Justice Barka bin make di declaration as e dey deliver judgment for two separate appeals wey senator Esther Nenadi Usman plus di caretaker committee and di Independent National Electoral Commission (Inec) file.

Di appellate court for di two separate appeals hold say dem no put hand for di issue of di leadership of di Labour Party bicos dem no dey carry dos kain mata come court.