Nenadi Usman, Julius Abure - Who be main leader of Labour Party for Nigeria?

Merged photos of Nenadi Usman and Julius Abure

Wia dis foto come from, Nenadi Usman/X/Labour Party Nigeria

Read am in 5 mins

Di Labour Party, one of di main opposition parties for Nigeria don choose new leader, and di pesin na former Minister of Finance, Nenadi Usman.

Na for di emergency National Executive Council (NEC) meeting wey dem hold on Wednesday, September 4, for Umuahia, di Abia State capital, dem announce madam Usman and 28 odas as membas of di new caretaker committee wey go handle di affairs of di party.

Almost all di big name for di Labour Party attend dis meeting wey di Govnor of Abia State, Alex Otti convene.

From Peter Obi di party presidential candidate, Yusuf Datti Baba-Ahmed im running mate, reach Senators, House of Representative members and State Assembly members wey belong to di party.

Govnorship candidates of di party for different states, like Gbadebo Rhodes-Vivour of Lagos State, Chijoke Edeoga of Enugu State and Athan Achonu of Imo state, including representatives of di Nigeria Labour Congress (NLC) and di Trade Union Congress (TUC), also dey di meeting.

But di National Publicity Secretary of di Labour Party, Obiora Ifoh, don release statement wia e say di NEC meeting for Umuahia dey illegal, null and void.

Clear division

Group Photograph of top leaders of Labour Party, Nigeria

Wia dis foto come from, Labour Party

Wetin we call dis foto, Plenty of di who be who for Labour Party attend di NEC meeting for Umuahia Abia State on Wednesday, September 4, 2024.

For im statement, Obiora Ifoh wey be di toktok pesin of Labour Party unda di Julius Abure exco, tok say Alex Otti no get any power for di constitution of di party to call for a NEC meeting.

"Di so-called meeting for Umuahia na joke, and na waste of time and resources of Abia pipo," Ifoh write.

"No vacuum dey for di leadership of di party. So, di so-called caretaker committee wey di govnor of Abia State set up no dey known to di constitution of di party and we go just call am a department for di Abia State Government House."

Ifoh tok say even di Nenadi Usman wey emerge as di caretaker committee chairman, no be memba of Labour Party, rather she na pesin wey just come out to support Peter Obi during di election period.

E insist say Julius Abure remain di National Chairman of Labour Party bicos di party bin don do dia National Convention for Nnewi, Anambra State for March dis year.

For di oda side of di pipo wey want Julius Abure to comot for office, Wednesday NEC meeting na step in di right direction.

Aisha Yesufu wey be activist and vocal supporter of Peter Obi, even though she tok say she no be Labour Party member, tok say dis go make Labour Party to "realise dia potential" and stop playing "local champion" politics.

"For me, in leadership of an organisation, di greater good suppose come first bifor personal good. Even if you be di best tin afta jollof rice, wen pipo say time don reach to move on and get in new leadership, you no suppose remain dia," Yesufu tok.

Yunusa Tanko, di Director of Media for Labour Party, no dey available to tok to BBC Pidgin.

Members of Labour Party NEC

Wia dis foto come from, Abia State goment

Wetin Labour Party law tok?

Di constitution of di Labour Party give power to di National Executive Council (NEC) "to dey responsible for di overall administration and organization of di Party", and membership of di NEC include all govnors and deputy govnors wey win election on di party platform, among odas.

Oda powers of di NEC na:

  • To deal wit problems wey lower organs of di Party bring to dem.
  • To make rules for Party discipline and loyalty
  • To decide on and convene Special National Conventions and Congresses, etc.

Di NEC na di second highest decision making body for di Labour Party afta di National Convention.

For di meeting for Umuahia on Wednesday, di NEC give di new caretaker committee 90 days to conduct congresses for all di wards, local goment areas, and state across di kontri wey go prepare di ground for a national convention wia di party go elect new leaders and di National Working Committee.

Wetin oda top LP membas tok

Screenshot of tweet by Pat Utomi supporting Nenadi Usman as new Labour Party leader

Wia dis foto come from, Screenshot/X

Wetin we call dis foto, Pat Utomi, ogbonge leader for LP say e support Nenadi Usman as dia new leader

On di social media, some popular membas of Labour Party don drum support for di new caretaker leadership of di party, including Pat Utomi, one of di pipo wey help bring Peter Obi into di Labour Party in 2022.

Utomi tok say di decision go "set di party on course for di renewal of Nigeria and advance of di common good".

Kenneth Okonkwo, di popular actor and former toktok pesin of di Obi/Datti campaign, also posted on X and hail Alex Otti for calling di NEC meeting.

"Senator Nenadi Usman na personable, intelligent pesin who go deploy her experience and motherly kindness to carry di party comot for dis trying period," Okonkwo tok.