Why UK wan deport dis Nigerian student from Dundee University

Wia dis foto come from, Dundee University
One Nigerian Masters student dey face jail and deportation afta one jury find am guilty of sake of di terrorist threats im make against Dundee University.
Somtochukwu Okwuoha claim say im hire Isis to help bomb di university and im tell staff im plan to target di city wit a chemical attack.
Authorities find di international energy student guilty of seven charges and lock am up for dia custody.
Na next month dem go sentence di 26-year-old.
Sheriff William Wood go also consider di Crown motion for an order to deport Okwuoha to Nigeria.
One trial hear say Okwuoha tell university staff say im plan to carry out mass murder for Dundee University campus.
Witnesses describe how Okwuoha claim say im get military background and im dey capable of making bombs and fit unleash deadly virus for di city.
'Blood go spill'
Keith Mackle, 58, wey now be retired director of student services, tell Perth Sheriff Court im know about di "serious concerns" for autumn of 2021.
End of Di one wey oda users dey read well well
E say staff members receive emails wia im make terrorist threats.
One pesin say: "Expect one massive bomb explosion for di University of Dundee. I don contact Isis terrorists to plant bombs on campus.
"I dey assure you say staff and students go die in great numbers. 9/11 go be like joke compared to wetin wey go happun.
"Blood go spill and flesh go scata."
Accommodation officer Shane Taylor tell di court say Okwuoha accuse am of being racist e add say im plan to wipe out Scottish pipo as revenge.
Dem find Okwuoha, wey be prisoner for Perth, guilty of threatening to murder staff for di university and commit terrorist crime between December 2021 and June 2022.
Dem find am guilty of threatening to commit mass murder, using biological weapons, revealing staff details to international authorities, and claiming say im don plant bombs.
Dem also find Okwuoha guilty of threatening to behead police officers and detonate bombs wey im don plant for Dundee University.
Sake of di new informate wey we don see concerning di photo we use for dis tori, BBC News Pidgin don remove di former photo and update di tori on 5/08/2025.













