Peter Obi explain im involvement with ADC as Labour Party give am 48 hours to resign

Peter Obi and Labour Party logo

Wia dis foto come from, Labour Party/X

Read am in 5 mins

Di Nigeria Labour Party, LP, don give Peter Obi, di party presidential candidate for di 2023 general elections 48 hours to formally resign from di party.

Dis dey come as di former Anambra state govnor join one coalition opposition figures wey don adopt di African Democratic Congress (ADC) as dia new party.

Di former presidential candidate of di Labour Party for di 2023 election, Peter Obi, say di African Democratic Congress, ADC coalition go always put Nigerians first for all dia decisions.

E tok dis one afta e show im support for di ADC, as di party di coalition of top opposition figures for di country chose as platform to unseat di ruling All Progressives Congress (APC) for di 2027 general elections.

Oga Obi say di decision to join ADC no easy but dia commitment na to sacrifice and work togeda to provide competent and compassionate leadership for Nigeria.

"Dis decision no come lightly. E come from deep reflection on wia we dey as a kontri and wetin we must do to move forward.

"No one group fit change Nigeria alone. To scata di structures wey keep our pipo for poverty and insecurity, we must build bridges, no be walls even wen those bridges no dey easy.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 1

'We give you 48 hours'

Di National Publicity Secretary of di Labour Party Obiora Ifoh for one statement say dia party no get interest to join di coalition, plus members of di coalition na "power mongers wey dia only interest na for dia self no be di pipo."

Oga Ifoh also add say na those wey mismanage Nigeria ova di years gada themselves togeda for di coalition, as e note say, "desperate politicians no fit birth new Nigeria."

Di Labour party for di statement reveal say dem dey aware say Oga Obi dey lobby dia members to join am for di new party.

"We dey aware of several night-time meetings between Peter Obi and some of our members, as e dey lobby dem to join am for im new party. We also know say some of dem don refuse to defect wit am.

"Labour Party don consistently tok am say dem no be part of coalition and any of our members who dey part of di coalition get 48 hours to formally resign im membership from di party," di party tok-tok pesin tok.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 2

Leaders of main opposition parties join di ADC

No be only di former LP presidential candidate join di coalition, di presidential candidate of di Peoples Democratic Party (PDP) Atiku Abubakar also join di new party.

Di two pipo be di main opposition leaders, and dem hope say through dis coalition dem go fit challenge President BolaTinubu and im ruling party for di next election.

Di two opposition leaders chose di African Democratic Congress (ADC) as dia new political home afta dem break away from dia respective parties – di Peoples Democratic Party (PDP) and di Labour Party (LP).

Some political heavyweights from Oga Tinubu All Progressives Congress (APC) party don also throw dia weight behind di formation.

Nigeria politician Peter Obi

Wia dis foto come from, Peter Obi/X

Obi and Abubakar go fit work togeda again?

Dis na di question for di lips of many, as Obi large support base no wan see am dey play second fiddle to anyone else - and dis na why e comot di PDP to join di Labour Party for di last election.

While Abubakar supporters feel say as e be di only former vice-president wey dey fight for di presidency, every oda politician naturally come second.

Wen di two politicians work togeda for 2019, wit Obi serving as Abubakar running mate, dem lost to APC Muhammadu Buhari.

Wen Obi leave di PDP for LP for 2022, na peaceful separation wey no get issue.

Di former govnor bin tok at di time say im dey move go LP bicos e align wit im aspirations.

As if both of dem know say fate go bring dem back togeda, dem no tok bad of each oda either bifor or during di 2023 campaign.

E go dey interesting to see how tins go work out between now and 2027.

Members of di coalititon

Wia dis foto come from, Peter Obi/X

Di ADC na new party?

ADC na party wey don already dey exist, e get acronym wey close to di All Democratic Alliance (ADA) dem bin wan register.

Founded in 2005 as di Alliance for Democratic Change by Mr Ralph Nwosu - a politician from Awka, Anambra State, in di southeast region of Nigeria - di party later change dia name to African Democratic Congress and dia slogan na 'Arise and Shine Nigeria'.

Inec register dem in 2006 ahead of di 2007 general elections wia di party bin get candidates but dem no win any position. Dia first presidential candidate na Professor Pat Utomi who get just about 50,849 votes for dat election.

Dia first win bin come in di 2011 elections wia dem win some five seats for di National Assembly.

From di 2007 general election till date, di ADC don put out presidential candidates for each election:

  • Patrick Utomi - 2007
  • Rev Peter Uchenna Nwangwu - 2011
  • Dr. Mani Ibrahim Ahmad - 2015
  • Obadiah Mailafia - 2019
  • Dumebi Kachikwu - 2023

Di ADC primary election for di 2023 general election bin cause plenty controversy as two big aspirants - former deputy govnor of Central Bank of Nigeria, Kingsley Moghalu and Dumebi Kachikwu face-off.

Eventually, Kachikwu win di primary and contest di election wia e get only 78,930 votes.