Better to comot from PDP dan to destroy am - Damagun

Foto of some ogbonge leaders of di Peoples Democratic Party for dia 100th NEC meeting

Wia dis foto come from, PDP

Wetin we call dis foto, Foto of some ogbonge leaders of di Peoples Democratic Party for dia 100th NEC meeting
Read am in 5 mins

Di main opposition party for Nigeria, di Peoples Democratic Party don agree make Samuel Anyanwu kontinu to be di National Secretary of di party.

Dis dey come afta dem hold dia 100th NEC meeting on Monday for Abuja afta kasala bin happun earlier for di party secretariat.

Dem also fix date for di proper National Executive Council [NEC] meeting wey go hold on July 23.

Di Acting National Chairman of di party, Umar Damagun, confam say di meeting wey dem dey hold na NEC meeting and no be di stakeholders caucus meeting wey di oda group bin want.

Im add say di NEC go discuss only one agenda, di agenda na wen dem go hold di proper NEC.

And na for di proper NEC meeting dem go discuss di issues wey relate to di PDP convention and wen e go happun.

E tell members of di party make dem stop "to tok bad tins" about di party. Damagun add say make pipo wey wan comot no destroy di party becos 'enof is enof'.

Tori be say afta di NEC meeting all di PDP govnors hold closed-door meeting for di Bauchi State Governor's Lodge for Asokoro, Abuja.

Di Governors wey attend di meeting na Bala Mohammed of Bauchi State, Douye Diri of Bayelsa State, Seyi Makinde of Oyo State.

Former Senate President, Bukola Saraki also attend di meeting

Police bin takeover PDP secretariat

Kasala outside PDP secretariat for Abuja

Wia dis foto come from, Screenshot/PDP/Facebook

Kasala bin burst for di Peoples Democratic Party [PDP] secretariat on Monday afta security pipo allegedly harass officials of di party wey bin wan attend dia National Executive Council meeting.

One video wey di PDP post for dia official social media page show how men wey appear to be police be like say dem dey carry pipo up and force dem out of di premises.

However, oda local media dey report say policemen mount guard for di gate of di hall wey di NEC meeting suppose hold.

Tori be say police officers no allow members of di PDP Board of Trustees [BoT] enta di venue of di meeting.

BBC Pidgin bin tok to former National Secretary of di Peoples Democratic Party, Kola Ologbondiyan wey confam say armed policemen block di headquarters of di Peoples Democratic Party secretariat for Abuja so dat di NEC meeting no go hold.

"Dem no disrupt di meeting becos di meeting bin neva start, na wetin don already start dem dey disrupt, but wetin happun be say dem no even allow di meeting start, so we don change venue, make una help us ask police who give dem di order to stop members and workers of di PDP?"

Tori be say di police no even allow di BoT members to hold dia meeting wia dem suppose happun ahead of di expanded caucus meeting.

Channels Television report say di former National Secretary of di PDP, Umar Tsauri, tok say di police stop di BoT members, im say dem dey act based on an "order from above".

Even though some staff members of di party bin enta di secretariat freely, police later pursue di staff and journalists from di secretariat.

Wetin dey cause di current wahala

Di former National Secretary of di Peoples Democratic Party, Kola Ologbondiyan explain to BBC Pidgin say di implications of dis two meeting be say "For di last meeting wey happun on May 27, Nec bin hold meeting wia dem bin agree to meet again today June 30.

Unfortunately di Damagun side of di party wey dey work wit some members wey no be part of di national Working Committee [NWC] come up wit decision say dem need to postpone di Nec or change am to a stakeholders caucus meeting."

Im tell BBC Pidgin say nothing like stakeholders caucus meeting dey for di PDP Constitution.

According to him, na Damagun faction dey call for stakeholders caucus meeting now while di oda faction no gree, dem match leg for ground say nothing like stakeholders meeting dey dia constitution and dem go uphold di decision of di Nec meeting wey bin hold of 27 May, wey be di second highest organ of di party and dem must obey di decision wey dem make.

Di implications of dis two meetings and disagreements na say from di last NEC meeting, dem resolve say June 30 dem go take decision on di position of di National Secretary because earlier dem bin don resolve say make di South-East zone nominate dia replacement.

Di South-East zone bin don already present dia report for di meeting wey bin hold on May 27.

Nec resolve say dem no go take dat report until di next Nec meeting wey be June 30.

"So if di Damagun group dey operate within di realm of di political system, dem suppose allow di Nec meeting hold so dat dem go take decision on who di National Secretary go be".

Im claim say di Damagun group now dey waka upandan dey claim say Inec chairman, Prof Mahmood Yakubu don give instruction say make notin happun to Anyanwu, dem no go fit replace Anyanwu but Ologbodiyan tell BBC Pidgin say "na lie , Inec no tok like dat, Inec no go fit choose for any political party who dia officials go be, e no dey within di law, e no dey within di statues." im add.

Concerning di alleged Court judgement wey di Damagun group dey refer to, say na di judgement wey Inec too dey refer too, oga Ologbodiyan tok say " dem just dey dance around becos Inec sef don tok say dem no tok like dat, say dem only ask di party to go bring dia National Secretary"

Im go further to explain say one NGO bin write to Inec to bringout di Certified True Copy of di publication wey Inec send to PDP wey tok say Setonji Koshoedo no go fit act as National Secretary.

Oga Kola clarify say Inec clearly reply di NGO say "dem no ever tok say Setonji Koshoedo no fit function as Acting National Secretary.