Pope health don improve but e still dey hospital - Vatican

Wia dis foto come from, Reuters
- Author, Thomas Mackintosh
- Role, BBC News, London
- Read am in 2 mins
Pope Francis, wey don dey battle pneumonia for two weeks, dey show signs of improvement now. Dis na according to wetin di Vatican tok for medical update.
Di Vatican on Friday tok say e go still dey hospital sake of complex clinical picture.
E add say di 88-year-old don get anoda "peaceful night" and dey "now rest" for di Gamelli Hospital for Rome.
Di Italian news agency Ansa report say report say di pope don comot di "critical phase", as dem cite Vatican sources.
Di Pope bin dey admitted go hospital on 14 February afta e face breathing difficulty for many days.
Dem bin first treat am for bronchitis bifor dem diagnose am wit pneumonia for di two lungs.
Den for 22 February, di Vatican say di Pope bin face respiratory crisis and bin dey "critical" condition but later on Sunday dem release update say im "no get any new respiratory crises".
Di next day, di Pope comot statement wia im ask Catholics make dem pray for am afta e no fit deliver di traditional Angelus prayer in pesin for di second week in a row.
But di Vatican say di Pope health dey improve say "further days of clinical stability dey necessary to solve di wahala."
Di Pope dey very likely to dey affected by pneumonia wey be infection of di lungs wey bacteria, virus or fungi dey cause, bicos e bin get pleurisy, wey be inflammation of di lungs, wen e be young man, wey make dem comot part of im lungs.
Dem don admit di leader of di Roman Catholic Church go hospital plenti times for im 12 year tenure. Dis include wen dem treat am of bronchitis for di same hospital for March 2023.
Di Pope wey come from Argentina na di first Latin American and first Jesuit wey go lead di Roman Catholic Church.








