Why International Women's Day dey important as celebration dey happun today

Wia dis foto come from, Getty Images
Na ova 100 years e don be wey pipo all ova di world don dey mark International Women's Day for 8 March.
But wetin di day dey about and why e mata?
How International Women's Day take start?

Wia dis foto come from, Getty Images
International Women's Day bin comot from di labour movement.
Di issue bin start for 1908 wen 15,000 women march for New York City to ask for shorter working hours, beta moni and di right to vote.
Afta one year di Socialist Party of America declare di first National Women's Day.

Wia dis foto come from, CORBIS / HULTON DEUTSCH
Na communist activist and advocate for women rights Clara Zetkin turn am to international event for 1910 wen she table di mata for one International Conference for Working Women for Copenhagen.
Di 100 women for 17 kontris wey attend di conference follow back her conference.
Di first International Women's Day bin happun for Austria, Denmark, Germany and Switzerland.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di United Nations (UN) bin start to mark di event for 1975. Di first theme wey dem use for 1996 na "Celebrating di Past, Planning for di Future".
Why International Women's Day dey hold on 8 March?
Ms Zetkin original idea na make dem no put di international celebration for one particular day.
Di 8 March bin come afta Russian women bin protest for "bread and peace" during war time strike for 1917.
Four days to di strike, di tsar bin dey forced to comot and di provincial goment give women di right to vote.
According to di Julian calendar wey dem bin dey use dat time for Russia, di women strike start for 23 February.
For di Gregorian calendar wey dey used for di rest of di world, dat date na 8 March.
How dem dey take celebrate International Women's Day all ova di world?
International Women's Day na national holiday for plenti kontris. For China, many women dey get half day of work off, as di State Council take advise.
Plenti events dey hold worldwide like marchs, tok-tok, concerts, exhibitions and debates.

Wia dis foto come from, Getty Images
For Italy, dem dey call IWD Festa della Donna, mimosa blossoms na di popular gift to give. For Russia, di sale of flowers dey double around International Women's Day.
For di US, March na Women History Month. Presidential proclamation wey dem dey issue evri year dey honour di achievements of American women.
For Instagram Post for di beginning of March 2024, American President Joe Biden say di month go "celebrate di legacy of sung and unsung trailblazer and advocates wey don make di world a fairer, more just and freer place."
Why pipo dey wear di colour purple for International Women's Day?
According to di International Women's Day website, purple, green and white na di colours of IWD.
E tok say, "Purple mean justice and dignity. Green na for hope. White represent purity, even though na controversial concept".

Wia dis foto come from, ELIZABETH CRAWFORD
Na dis colours one group for di UK wey dem dey call di Women's Social and Political Union (WSPU) bin use for 1903 to take fight for women votes.
Wetin be di theme for di 2024 International Women's Day?
Di UN theme for 2024, na "invest in women, Accelerate progress" wey go highlight di importance for gender-equality measurers.
Di UN warn say, "kasala and rise on prices fit make 75% of kontris to cut public spending by 2025 wey go affect women badly and dia essential services."
Di International Women's Day website say dia theme na "Inspire Inclusion". E say organisers and events wan "break down barriers, challenge stereotypes, and create space wia all women dey valued and respected."
Why campaigners dey argue say International Women's Day dey needed?
Organisers say di day na opportunity to mark di progress dem make but also showcase di way women rights dey troway for di world as well as effects of gender violence and abuse.
For di past 12 months, women for di Middle East, Afghanistan, Iran and Ukraine don dey fight for dia rights even inside war and kasala.
UN sabi pipo say dem don get credible allegations of human rights violations against women and girls for Gaza, including cases of rape by Israeli forces.
Di BBC don also see evidence of rape, sexual violence and mutilation of Israeli women during di 7 October Hamas attacks.

Wia dis foto come from, NAVA JAMSHIDI/BBC
For Afghanistan, Taliban ban girls wey don pass primary school age from going to school. Di Taliban dey deny women access to equal education.
For Iran, many pipo still no dey mind di rule wey say women must to cova dia hair as activists like di Nobel Peace Prize laureate Narges Mohammadi dey face long jail term.
Di UN say dem dey kidnap and rape women and girls for Sudan for areas wey di Rapid Support Forces (RSF) dey control - dem dey hold dem for ransom and dem dey also force dem to marry.
According to di 2023 Global Gender Index, wey di World Economic Forum dey publish evri year, no kontri don get full gender equality or parity.
Dem warn say e fit take more than one hundred years before e reach worldwide.
International Men's Day dey?
International Men's Day don dey hold for 19 November since di 1990s.
Di event neva dey recognised by di UN but na ova 80 kontris for di world dey mark am.
Di day dey focus on "di positive value wey men dey bring to di world, dia families and communities", according to organisers.
Dem wan show positive role models, raise awareness for men health and improve gender relations.
For many years, comedian Richard Herring don gada tens of thousands of dollars for domestic violence charity wey dem dey call Refuge every International Women's Day, by replying to pipo on X wey bin dey vex say International Men's Day no dey.













