France make abortion a constitutional right

Wia dis foto come from, Getty Images
France don become di first kontri in di world to put di right to abortion inside dia constitution.
Parliamentarians vote to revise di kontri 1958 constitution to enshrine women "guaranteed freedom" to abort.
E become di 25th amendment to modern France founding document, and di first since 2008.
Polls show around 85% of di public support di reform.
Prime Minister Gabriel Attal tell parliament say di right to abortion remain "in danger" and "at di mercy of decision makers" bifor di vote.
"I dey tell women, within our borders and beyond: di era of a world of hope dey start," e tok for di parliamentary congress in Versailles.
Effect of Roe v Wade ruling
Abortion don dey legal for France since 1975, but President Macron don promise to include am in di constitution afta di US Supreme Court 2022 decision to reverse di Roe v Wade ruling.
E overturn di 50-year right to abortion in di US, as e dey allow individual American states to ban or control am, and e don make activists to push France to become di first kontri to clearly protect di right in basic law.
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, Getty Images
"Dis right (to abortion) dem don withdraw am for United States. And so notin authorise us to tink say France no dey exempt from dis risk," Laura Slimani, from di Fondation des Femmes (Women Foundation) rights group, tell BBC.
"We know say e go be big celebration," Anne-Cécile Mailfert, one activist from di same group, tok dis for news conference bifor di vote.
"At di moment of di vote, di Eiffel tower go shine and e go send important message to di world too."
History of abortion law for France
For France, di right to abortion don dey for dia law - no be, as e dey in di US, by one single Supreme Court ruling - since 1975.
Since den, di law in France don dey updated nine times - and on each occasion wit di aim of extending access.
France constitutional council - di body don decide on di constitutionality of laws - e neva raise query.
So, according to many jurists, abortion don already dey constitutional right.

Wia dis foto come from, Getty Images
In 1971, as di campaign to legalise abortion in France gada momentum, one petition dey signed by 343 women across di kontri.
Known as di "Manifesto of di 343", di women admit to don dey illegally comot pregnancy at di time wen estimate of 700,000 to 800,000 women abort each year.
"Di behaviour of di US Supreme Court do women all around di world favour becos e wake us up," Claudine Monteil, head of di Femmes Monde (Women in di World) association, tell FP.
She be di youngest signatory of di manifesto.
Abortion laws globally
Supporters of di French reform say e dey necessary to guard against new wave of "reactionary" social change for Europe wey fit go put pipo wey wan restrict di right to abortion for power.
Dem point to kontris like Malta, Hungary and Poland wia dem don already put limits in place or di subject of much debate.
"In women rights, symbols count," feminist lawyer Rachel-Flore Pardo say di constitutional change.
"Tomorrow dem become our battlements. To wait until abortion dey actually under threat e go be to wait too long."
Leah Hoctor, of di Center for Reproductive Rights, said France fit offer "di first explicit broad constitutional provision of im kind, not just in Europe, but also globally".
Chile include di right to elective abortion in one draft for new constitution in 2022 but voters rejecte di text in referendum.
Some kontris mention di right. Cuba constitution guarantees women "reproductive and sexual rights".
Several Balkan states don inherit versions of former Yugoslavia 1974 constitution wey say na human right to "decide on di birth of children".
Oda states explicitly mention abortion in dia constitution but only permit am in specific circumstances.
'Na defeat for women'
Most members of di French public support di move to give di right to abortion extra protection.
November 2022 survey by French polling group IFOP find say 86% of French pipo support writting am for dia constitution.

Wia dis foto come from, Getty Images
Left-wing and centrist politicians don welcome di change, while right-wing senators don say for private dey feel di pressure to give am di green light, AFP report.
One tok say im daughters "no go come for Christmas" if she go against di move.
Abortion opponents don plann protest for Versailles on Monday afternoon.
"Na defeat for women," Pascale Moriniere, president of di Association of Catholic Families, tell BBC.
"And of course, for all di pikin dem no go fit see di day."














