Arsenal beat Barcelona to win Women's Champions League title

Arsenal beat Barcelona to win Women's Champions League title

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 3 mins

Arsenal beat Barcelona 1-0 to win di 2024/2024 Uefa Women’s Champions Leagu.

Substitute Stina Blackstenius score di only goal for di match for second half to win di title for Arsenal.

Dis na Arsenal second time to win di trophy for dia history as Uefa crown dem di new European champions.

Di first time Arsenal win di Champions League trophy na for 2007 while Barcelona win am last season.

Barcelona wit new coach Pere Romeu also fail to defend di title wey dia former coach bin win three times before im comot from di club.

Na Lyon get di most title wins for di competition. Dem get a total eight titles.

Arsenal Coach Renee Sledgers make history

Renee Slegers

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Renee Slegers don only manage games for di Champions League group stage before dis season

Arsenal manager Renee Slegers don also make history as she win di Champions league title for di London club afta over 15 years.

Di Gunners get to dis point get afta 15 games unbeaten run to win dis tournament.

Dem start from di veri first round of qualifying.

Since dat 2007 victory, no manager don eva match im success and guide a British side to di European title. But e fit change.

Just four months afta dem name Arsenal head coach on a permanent basis, Renee Slegers get di chance to lead di Gunners to European glory once more.

Slegers bin tell Uefa say di final on Saturday "go dey so special,"

About Barcelona, she say "We respect dem highly as a team. All of dem na veri intelligent players and technically capable, so e go be a new challenge. I tink na challenge wey we neva face yet for di league or di Champions League. We go try to replicate as many moments as possible in training and prepare for evritin wey go come."

Head to head

Barcelona and Arsenal don meet five times for all competitions. Arsenal win two Barcelona win three.

Di first time na for club friendlies for 2019 wen Arsenal lose to Barcelona 2-5.

For October 2021 Barcelon beat Arsenal 4-1 while for December same year Arsenal lose to Barcelona 0-4

Barcelona neva lose dia last six matches for all competitions dis season while Arsenal don win three and lose three.