Asisat Oshoala comot Barcelona to American Bay FC

Asisat Oshoala

Wia dis foto come from, Getty

Nigerian footballer, Asisat Oshoala don complete a move from Barcelona to di American side Bay FC for California.

Barcelona wey drop dis informate for statement say, "di club thank am for di past five years wey she don dey wear our jersey."

Asisat contract with di Spanish side suppose end for June 30, 2024.

In di five years way she dey with di club she don score 117 goals in 162 days.

Meanwhile, Bay FC don also confam di move for dia social media ccount.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

For her time with Barca, she also gbab 14 trophies dem.

Di trophies include two Champions League, four Ligue, three Queen's cups, four Spanish Super Cups and one Catalan Cup.

Oshoala na di fourth top goal scorer for di history of di club.

Di 29 year old, wey dey named African Women's Footballer of di year for di sixth time in December, don sign deal till 2026 with option to sign for third year for di National Women Soccer League (NWSL) team.

Before she join Barcelona for 2019, she bin play for Robo Queens and River Angels for Africa, Liverpool and Arsenal for England and Dalian Quanjian for China.

She be di first African woman wey go win Champions League title for 2021. Dis na afta she become di first African woman to score for final for 2019.

'Bay FC dey excited to get Oshoala'

Bay FC General Manager Lucy Rushton tok say, "Asisat na proven goal scorer for di most elite levels for world football."

She add say, "to get opportunity to fit add player wey get Asisat quality, experience and winning pedigree to our side na exciting and important day for di club and NWSL".

Asisat joining di club dey come as dem dey prepare for dia first NWSL campaign as di competition dey expand to 14 clubs.

Rushton hail her say, "she dey bring top class mentality come field plus including pace and technical ability wey dey allow her to lead di line."