Check dis tins bifor you finally stop to dey take sugar

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Fatuma Maalim Abukar
- Role, BBC News
- Reporting from, Somali
Many pipo don stop dey eat sugar nowadays.
E fit be sake of plenti reason like say dem dey change dia lifestyle and food wey get low carbohydrate.
But wetin be di biggest reason be di danger wey too much sugar don dey pose for our health.
Say you go reduce di sugar for body get plenti benefit - like im dey reduce calories, wey e fit help lose weight wey im also be good for dental health.
Carbohydrate dey inside many tins, like sugar wey don dey inside natural food such as fructose from protein and lactose from milk.
One medical sabi pesin, Dr Abdirahman Dhiblawe tok BBC say if pesin eat plenti sugar, e fit lead to weight gain.
“Di world see say if pesin dey overweight, im get risk of many sickness like diabetes, high blood pressure, joint pain and heart disease,” im tok.
Pesin body dey need sugar?

Wia dis foto come from, Getty Images
“Wetin be important be how much wey di body don need. We no fit tok say di body no need am, our brain dey use sugar.
End of Di one wey oda users dey read well well
“If di body no get sugar, di brain don make sugar from protein and fat, so e dey necessary for di body but di amount allowed always dey limited,” Dr Abdirahman Dhiblawe tok.
If di chemical balance for di brain don change, e fit cause negative effect of cutting out sugar.
Make we give up normal sugar, di kind we don dey add to tea, coffee and oda tins?
“Pesin don dey forget say plenti of our food na sugar. If you chop dem alone, e get plenti sugar,” im add.
Di sugar type our body dey need to do im job, na glucose.
Sabi pipo say di body dey get plenti energy from glucose.
E mean say e no dey need say pesin go add glucose to dia diet because di body dey do am naturally by breaking down food like fat, protein and carbohydrate.
Benefit of sugar to di body
Sugar gatz benefit for di body, like di way im dey help di brain.
“E dey give energy, to go about for di day, di joy say you happy, your skin don dey light wia your mind be sharp,” Dr Dhiblawe explain.
Sabi pipo tok say di brain dey need more than 100g of sugar every day to do im work.
Sugar also don increase pesin im feeling of happiness because di body dey get energy from am.
If pipo dey feel stress, sugar don dey change dat feeling to happiness.
Sugar also dey fit cleanse di body wia e dey remove dead skin.
Wetin sugar and diabetes get in common

Wia dis foto come from, Getty Images
Pipo wey eat plenti sugar don dey at risk of sickness like diabetes, heart disease and cancer but e no be sugar alone dey cause dis wahala.
Dr Diblawey say many oda tins dey wey fit cause dis sickness.
“Diabetes dey show in different way, wia sugar no dey cause am directly. E fit be hereditary. If pesin increase weight, im dey reduce insulin secretion.”
Two types of diabetes wey dey. Di type 1 and type 2.
Sabi pipo tok say normal sugar no dey cause type 1 diabetes, na di cells wey dey produce insulin wey don dey destroyed by di immune system.
But for type 2 diabetes, too much sugar wey pesin eat directly or for foods and drinks don dey cause am.
Wetin dey happun if pesin give up sugar?

Wia dis foto come from, Getty Images
If you stop dey eat sugar, e get negative effect like headache, say pesin go taya quick quick and mood change.
“You go experience say you no get energy, you no fit do plenty work, you no go happy wia you go sweat plenty.”
Di sugar wey don dey cause dis, na regular sugar wey dey our food.
“E for dey neutral, e for dey balance.”
Pesin ever fit stop dey eat sugar?

Wia dis foto come from, Getty Images
Dr AS Dhiblaawe tok say pipo dey wey dey eat plenti sugar but e no dey affect dem.
“Our population don dey mostly rural. Dem fit drink tea wit plenti sugar but dem also dey waka plenty.”
Im add say if pesin sit wit anoda pesin wey don dey eat plenty sugar, dat no be dangerous.
“We don dey monitor pipo afta we tok dem say make dem stop dey eat sugar. Ibi wrong say everibody go stop dey eat sugar, Dr Dhiblaawe add.
Im explain say wetin di pesin im weight and height be, for match di sugar dem Dey take.
Im advise pipo say make dem visit health sabi pesin wia dem for measure dia height and weight to see whether dey need to reduce dia sugar or not.












