Kasala burst as mourners dey pay last respects to Raila Odinga

Kenyan police faya tear gas give di big crowd of mourners wey gada for stadium for Nairobi to see di bodi of di kontri former Prime Minister Raila Odinga.
Dem bin also fire gunshots for di kasala but e no clear weda di police bin dey use live ammunitions or weda na rubber bullets dem shot.
Dis viewing dey come afta dem carry di bodi from India wia e die bring am come back house.
Tori be say plenti pipo injure for di kasala as security officers dey try chase di crowd as dem just dey grow dey go.
Di authorities tok say di mourners bin enta restricted areas wey make dem do wetin dem call "precautionary closure" wey bin last for like two hours.
Na sake of dis same reason of crowd size na im make dem shift di public viewing ceremony for oga Odinga comot from di parliamentary building wia e suppose hold, carry am go di Moi International Sports Centre for di Kasarani neighbourhood, for di capital, Nairobi.
Thousands of pipo bin follow di bodi from airport near di motor wey carry di bodi waka di go sdi stadium.

Wia dis foto come from, Reuters
Just few mintes later na im large group of pipo push enta one gate for di arena wey make di police fire tear gas. Dis cause plenti masses of mourners to start to dey run out.
One BBC tori pesin wey dey di area bin see men for civillian clothes dey beat pipo wit batons.
Di AFP news agency tok say like three pipo get visible injury and one bin get serious head wound.
Bifor all dis, supporters bin gada for Lee Funeral Home wia di bodi bin dey expected to come, den around di parliament.
One of di mourner tell di BBC near di airport, "I come hia by six for morning. We don dey for airport to welcome Baba (Odinga nickname)".
"We dey sad. E don leave us as orphans. E be our papa."
One okada man Willian Otieno Adoyo tok say, "Baba die-hard".
E tell di BBC, "we wan see Baba, how we go know say na im dey inside di casket? Make dem show us and we go dey okay".
Di state burial go happun for di Nyayo National Stadium for Nairobi on Friday and by Saturday im bodi go go Kisumu for western Kenya wey be di political stronghold.
Di public go fit see his bodi bifor dem bury am for im farm on Bondo on Sunday.
According to im familiy, Raila Odinga bin wish to dey laid to rest within like 72 hours.
Di 80 year old former prime minister bin collapse during one morning walk for India for Wednesday morning and dem take am go di Devamatha Hospital.
Dem declare seven day mourning period for am. Odinga go also get state funeral wit full military honours, according to di Kenyan President William Ruto.
Odinga bin tanda gidigba for di kontri as political main opposition leader. E don loose five presidential campaigns wit di latests wey happun three years ago.










