Outcome of meeting between Labour leaders and Tinubu over minimum wage

President Bola Tinubu meet wit labour unions ova minimum wage

Wia dis foto come from, Presidency/X

Leaders of di Organised Labour meeting wit Nigeria President Bola Tinubu for di State House, Abuja, di kontri capital don end.

Di president no reach any final agreement wit di organised labour unions on top new minimum wage.

President of di Nigeria Labour Congress (NLC) Joe Ajaero, President of di Trade Union Congress Fesuts Osifo plus dia respective teams bin hold one ogbonge meeting wit di president on Thursday 11 June, wit di expectation say di president go declare a new minimum wage for Nigeria.

But dat no happun.

However, afta di meeting, di minister of information Mohammed Idris wey follow tori pipo tok, say di issue na still work in progress and di meeting na continuation of di president regular consultation to reach new minimum wage wey go work for Nigeria.

Bifor di meeting, labour bin insist on N250,000 as new minimum wage, while di organised private sector and di goment team dey reason N62,000.

Oga Idris tok say during di meeting, di organised labour bin ask di goment to give dem one week to consult further and dem don allow dem. E say dem go come back afta one week.

“We go come back afta one week and we hope say at di end of di day, we go get something good for all Nigerians. Dis na step in di right direction and we hope say by next week, we go get something wey all Nigerians go agree wit.” Oga Idris tok.

Di issue of di national minimum wage wey don dey go on for months still neva dey concluded as labour unions and di federal goment neva come to agreement.

Labour insist on N250,000 minimum wage afta meeting wit Tinubu

Meanwhile president of di Nigeria Labour Congress, Joe Ajaero tok say di amount wey still dey on top table as minimum wage na N250,000 and N62,000 and na so e go remain until dem reach agreement.

E add say wetin dem go do for State House na to meet wit di president and discuss, no be for negotiation. “In di real sense, no be negotiation but na discussion and we don tok. We agree to look di mata in real terms and probably reconvene in di next one week.

“So, dat na wia we dey. Because we no go down there to talk naira and kobo.” Oga Ajaero tok.

Im counterpart for di Trade Union Congress Festus Osifo, tok say dem discuss and explain dia position give di president.

E say dem follow di presido tok sabout issues wey dey bite Nigerians, especially di price of commodities wey don go up.

“We make all di arguments, di economic analysis, macro, micro, fiscal and monetary issues. so we put everything forward and at di end, di president tok and all of us agree say we go come back and continue di meeting.”

On 3 June, di labour unions bin ground di kontri economy sake of di minimum wage kasala.

Di NLC and TUC bin first propose 494,000 naira ($311) as di new national minimum wage, as dem cite inflation and di economic hardship for di kontri.

Nigeria goment bin offer 60,000 ($35) wey di organised labour unions reject.

On 7 June, state govnors tok say dem fit no fit sustain N60,000 as minimum wage.

For di last meeting wit di tripartite committee, organised labour reject di 62,000 naira wey di goment dey propose and peg dia demand to 250,000 naira.

Di federal government don ask labour unions to demand a more realistic and sustainable wage.

Tinubu bin also direct Wale Edun, minister of finance, to present di cost implications for a new minimum wage.

Mohammed Idris, minister of information and national orientation, say di presentation go form di basis of further negotiations.