Woman comot her womb at 22 sake of severe pre-menstrual symptoms

- Author, Riyah Collins
- Role, BBC Newsbeat
Nichole bin start her period at di age of 12. For di next eight years, she bin reason say monthly suicidal thoughts, depression and severe anger na normal tin.
No be so.
From her first period, Nichole wey dey come from Stokes-on-Trent remember say she dey breakdown, get panic attacks and fly into rage.
She tell BBC Newsbeat say, "I no dey shame to tok am becos e bin dey as part of my sickness".
No be until wen Nichole turn 20, she find wetin dey do am, dem dey call di condition, premenstrual dysphoric disorder, or PMDD.
Na di elder and more severe version of premenstrual syndrome (PMS), but dis time e fit affect your quality of life and daily routine.
Different symptoms dey and some fit experience di wahala pass but dem be extreme mood swings, irritability, tiredness and e dey cause pipo to lose interest in usual activities.
And like Nichole, many fit wait for long before dem diagnose dem wit di condition.
End of Di one wey oda users dey read well well
Tori be say na like 5.5% of women get am and celebrities wey include Zara Larsson and Dixie D'Amelio don tok about dia experience wit di condition.
Di cause no dey known, although NHS say e fit dey genetic.
Nichole describe how PMDD bin affect am as allergy as she no dey react well to di hormone changes for her menstrual cycle.
'I bin want my life back'
Wen e bad pass, Nichole wey now be 25 years say she bin try to harm herself and na so she carry herself enta hospital for her safety.
She say, "I tell my surgeon, I know I go try and do stupid tin wen I get anoda episode and I no wan do dat. I no wan die."
Numbers from IAPMD wey be joinbodi wey dey torchlight on awareness for menstrual health tok say almost half of di women wey get PMDD don plan to commit suicide before.
Afta she try plenti tins like contraceptives and hormonal therapies wey no work, Nichole go meet her gynaecologist and na dia she find out say wetin remain na hysterectomy.
For 2021, dem comot her womb, cervix and both of her ovaries.
She say, "I bin find am hard say I no go get my own pikin."
But di alternative na to continue di suffering, Nichole tok, "as a 22 year old, wey don dey face am since I be 12, 10 years of pure hell, I bin need my quality of life back."
'Na you know your bodi pass'
Nichole say dem go need understand di link between mental and menstrual health.
Before dem connect wetin bin dey disturb her with her period, doctors bin wan put am on antidepressants even though e get some times for her cycle wey she dey absolutely fine.
Dr Nighat Arif na GP wey dey specialized on women health. She say di symptoms of PMDD dey resemble mental health issues.
She say, "e dey veri common for young girls to dey shunned and dey told say na mental health condition, wey no be di case.
"Di symptoms to find na emotional changes like extreme mood swings, tearfulness, sudden sadness, anger and even suicidal thoughts.
"Once you start to bleed, di pesin go feel like diasef again."

Wia dis foto come from, Nia Crockford
Although cure no dey and symptoms dey different for different pipo, 26 year old Nia Crockford don manage her own PMDD wit chemical menopause.
She first notice symptoms wen she bin dey 18 but dem tell am say na just painful period.
"I fit wake up one day and suddenly I no feel like di same pesin. Den e go disappear wen my period start. I get few weeks to dey fine before e start again."
Di treatment wey she dey do get hormonal injections to resemble menopause and dey make your periods to stop.
No be permanent tin and Nia fit born pikin for future and she dey see am as complete game changer.
Even though dat kain treatment no work for Nichole, Nia say e help am live normally and dey give am emotional stability.
E dey take like 12 years to dey diagnosed wit PMDD and Dr Arif say anybodi wey tink say dem get gatz sharparly tok to dia doctor.
She suggest make you keep symptom diary wia you go track your symptoms to wen your period start so you go fit identify am.
She say, "na you know your bodi pass. To understand wetin dey happun around your period time dey veri important."
Newsbeat don contact NHS to chook mouth.













