'Dem tiff my pikin three hours afta I born am for hospital'

Wia dis foto come from, Abel Leonard
- Author, Tamara Ebiwei
- Role, Broadcast Journalist
- Reporting from, BBC News Abuja
One family for Lafia, Nasarawa state, north central Nigeria dey devastated afta dia pikin loss for di post natal ward for one hospital.
Mrs Wosilat Suleiman born her son around 3:00am early mor-mor on Tuesday 9 January, 2024 through caesarean section (operation) for Dalhatu Araf Specialist Hospital, Lafia, Nasarawa state.
Dis hospital na one of di biggest hospitals for Lafia, wey get beta security. But one unknown woman allegedly tiff Mrs Wosilat Suleiman pikin.
Authorities say dem go do everything possible to recover di baby wey just come dis world barely three hours before dem separate am from im mother.
‘Di woman tell me say she wan go baff di baby’
Heartbroken Mrs Wosilat Suleiman wey dey 20 years old dey cry as she narrate wetin happun.
She tell BBC Pidgin say she dey devastated and she no want make anybody visit her again except her husband.
According to her, na around 6:00am in di morning on Tuesday 9 January na im one woman wey she no sabi carry her pikin from her relation hand inside di hospital.
“My relation wey dey look afta me as I born for di hospital introduce me to one strange woman wey she meet for di ward.
End of Di one wey oda users dey read well well
She bin wan go house go pick somtin. She tell me say di woman go take care of me and di baby before she come back from house."
Mrs Wosilat wey don born two children before explain say, she no know say her relation no know di woman well-well.
“My relation tink say di woman get patient (pesin wey dey sick) for di ward and she trust her to help us before she come back from house.
Di woman tell me say she wan go baff di baby, na so she disappear wit am,’’ Wosila tok as she dey cry."
Mrs Suleiman dey cry for help make dem help her find her missing child afta di woman deceive her carry her pikin run.
'Dis na di first time dis kain tin dey happun for hia' -Hospital explain
Authorities for di hospital no happy about dis mata at all as dem say belle no sweet dem say dis kain tin fit happun wit all dia plenti security measures.
Dr. Mohammed Salihu, wey be di Acting Head of Obstetrics and Gynaecology, surprise say dis kain tin happun sake of say e neva happun for di hospital bifor.
"Dis na di first time dis type of incident dey happun for here. We hand di baby to di mother initially, wey later hand di baby to her relative. Unfortunately, di trust wey di relative get for di woman wey she no sabi na im lead to dis tragic event."
Dr. Salihu confam say di hospital don report to authorities and police dey chook eye for di mata.
E say dem don summon staff of di hospital for questioning and dem go use dia CCTV footage to make sure say di criminal woman no go go free.
'We don arrest three suspects'- Police
Police for Lafia, Nasarawa state say dem don start to investigate how di unkown woman allegedly tiff newborn baby from hospital.
Di Nasarawa state Commissioner of Police, Umar Shehu Nadada tell tori pipo say na on 9 January,2024 wey one Suleiman Abdullahi of Timber shade report di mata to A division police station.
According to di CP, Suleiman Abdullahi wey be husband to Mrs Wosilat and father of di newborn baby, “im wife do caesarean operation (CS) for Dalhatu Araf Specialist Hospital, Lafia.
Im broda wife wey bin dey assist her bin wan go house to go collect charger, but unfortunately for her she hand over di pikin to one unknown woman.
By di time she comeback she no see di pikin and di woman, na so dem report di mata to us.” Oga CP tok
Oga Umar Shehu Nadada add say “investigation dey go on and I no tink say e dey connected to ritualist.”
Di Commissioner of Police add say di mata currently dey wit di Criminal Investigation Department (CID) and di management of di hospital dey assist dem to catch di suspects.
So far, dem don arrest three suspects and invite odas for questioning.
Child theft in Nigeria
Stealing of small children especially babies na one big issue security agencies dey try fight against for Nigeria.
Di mata don serious sotay parents and guardians don dey fear to give pipo dia pikin and wards to help dem hold or look afta for a short time.
Tori of how women dey lose dia children for hospitals, schools and for dia houses sake of bad pipo wey go pretend as good neighbours don full evriwia.
For Lagos, southwest Nigeria, local media report for June 2023 say police bin arrest one 49 years old woman sake of say she tiff one day old baby for hospital.
According to Lagos state Police Command tok-tok pesin, Mr Benjamin Hundeyin, na di Ojokoro Police Division arrest di woman afta dem receive report of di crime.
“She enter di female ward and carry a day-old baby boy, wen di mother dey sleep afta operation.
Anoda patient notice di fast movement of di suspect wit di baby for her hand, come alert di hospital authority."
Police discover say di woman come from Oyo state afta dem interrogate her.
For August 2020, Police for Katsina state arrest three women, including two nurses for allegation say dem tiff one new-born baby girl wey dem abandon for one private hospital.
Local tori pipo report say di Police Command tok-tok spokesman, SP Gambo Isah, say na di driver of one commercial tricycle wey di three women hire, na im hear dia discussion.
Police bin say one woman bin born di pikin on July 25, 2020 and abandon am sake of say she born am outside marriage.
Di two nurses for di hospital, pick di baby and allegedly sell am to one woman.














