'We bin don conclude arrangements to fly 12-year-old Debola to UK for treatment before im die'

Wia dis foto come from, Lagos State Government
Di Lagos State University Teaching Hospital (Lasuth) tok say dem bin don conclude di arrangements to transfer Debola Akin-Bright to Great Ormond Street Hospital for UK before im die on 19 September.
Lasuth yarn dis one for one statement dem release to mourn di death of di 12-year-old.
"Di entire management and staff of Lagos State University Teaching Hospital (LASUTH) commiserate wit di family of Adebola Akin-Bright, wey pass on Tuesday 19th September, 2023 afta two surgeries performed for one private hospital and one corrective surgery for our hospital.
"We wish to tank Mr Governor, Babajide Sanwoolu wey take over di expenses of keeping Debola alive till im e die," di statement tok.
Na close member of di family confam di death of Debola to BBC News Pidgin on Tuesday night and add say di boy bin get internal bleeding.
Im say dem rush Debola to intensive care unit for Lasuth, wia dem bin dey try save di situation.
Di family member say Debola give up inside di ICU.
Debola bin dey battle for survival afta dem perform multiple surgeries wia dem confam say im small intestine dey miss.
End of Di one wey oda users dey read well well
Two surgeries bin take place for one private hospital for Lagos bifor dem transfer am go goment facility, Lasuth, wia dem perform anoda surgery for dia.
Di boy death dey come afta members of di Lagos State House of Assembly bin visit Lasuth on Tuesday to assess di care wey di hospital dey give di boy.
Na di majority leader of di House Noheem Adams bin lead di seven-man ad-hoc committee members to di goment hospital, Lasuth tok for dia official X page.
Dem say na Oga Noheem tok say di purpose of dia visit na to investigate di case of “di boy wey im mama alleged say im intestine bin miss during surgery".
According to Oga Noheem, dem go make di result of dia investigation public once dem conclude am.
“Wen im dey speak, im (Oga Noheem) appreciate di Chief Medical Director, Prof. Adetokunbo. O Fabamwo and all di health professionals wey don ensure say all hands gatz dey on deck while giving excellent care to di patient,” Lasuth tok.

Wia dis foto come from, @LASUTHikeja
For di interview wit BBC News Pidgin, madam Abiodun say she never understand how small intestine go comot her son bodi and nobody know how e take miss.
Lagos state govnor Babajide Sanwo-Olu bin promise to pay for di medical treatment of di one 12-year-old boy.
Di govrnor visit di boy and im mama Deborah Abiodun wia im dey receive medical treatment for Lagos State University Teaching Hospital (Lasuth), Ikeja on Sunday.
Tok-tok pesin to di govnor Gboyega Akosile, on im X page tok say di govnor go provide financial and medical resources wey go save di boy life.
Di management of Lasuth bin tok say dem refer di 12-year-old boy come di hospital afta di private hospital don perform two surgeries on am.














