'We win di 2023 presidential election and we go prove am to Nigerians'

Wia dis foto come from, Peter Obi
Presidential candidate of di Labour Party for di 2023 presidential election, Peter Obi don react to di controversial election.
Obi for press briefing e hold for Abuja six days afta di election say im get record say im win di election.
Nigeria Labour Party Presidential Candidate, Peter Obi tok say e go torchlight all legal and peaceful options to prove say na im win di presidential election wey hold last Saturday.
Di electoral commission INEC bin declare Bola Tinubu of di All Progressives Congress as winner of di election wit 8 million votes.
For tok-tok wit tori pipo wey hold on Thursday, oga Obi tok say Saturday election, “no meet di minimum standard of free, transparent and credible elections.
“E go dey recorded as di most controversial elections for Nigeria history”.
Since di kontri election bodi Inec announce di candidate of di ruling All Progressives Congress, Bola Tinubu as winner of di 25 February 2023 Presidential elections, plenti tok-tok of I no go gree don full ground.
Di Labour party candidate Peter Obi win 12 states but im overall score put am for di third position for di race to Aso rock.
End of Di one wey oda users dey read well well
To win di presidential election for Nigeria, a candidate go need to get di most votes and 25% of ballots cast for two-thirds of Nigeria 36 states to be declared as di winner.
Dis article contain content wey Facebook provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Facebook cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Facebook post
'I dey committed to di Nigerian project'
Di LP candidate say e dey committed to di New Nigeria project and tell Nigerians say make dem vote for di upcoming govnorship elections for March 11.
E to say e no dey collabo wit any oda political parties but dey in partnership wit all Nigerians wey dey vex by di outcome of di election.
Oga Tinubu win di presidential elections with 37% of di votes with wetin dey described as one of di lowest turnout, most especially with di large number of voter card collection.
Howeva, Oga Obi dey beg Nigerians say make dem no japa as e dey wit Nigerians to right to make a new Nigeria.
E bin start di briefing wit one minute silence for all di pipo wey injure and die for di February 25 poll.
E also halla say how e dey possible afta 63 years of independence say dem no fit run election.
During di collation process for Abuja, di Labour Party agent and di PDP agent for di centre bin try stop di process sake of allege irregularities.
Di two parties bin hold joint press conference wia dem say dem no accept di result wey Inec dey announce.
Labour Party don already tok say dem go throw one legal challenge against di presidential election victory of Bola Tinubu of.
Peter Obi bin come third for di Saturday 25th February wit 6,101,533 votes.
Di Labour party and di main opposition PDP say di results dey rigged; dem bin call for fresh elections.
Na about 28% of eligible Nigerian voters take part for di polls.
Some pipo bin complain say dem no dey able to cast dia ballot sake of malfunctioning machines.













