Bola Ahmed Tinubu: World leaders congratulate Nigeria president-elect

Wia dis foto come from, Facebook/Bola Tinubu
Ukraine Presido, Voldymyr Zelensky don join world leaders don begin congratulate di president-elect Bola Tinubu afta di Independent National Electoral Commission, Inec declare am as di winner of di 25 February general elections.
Di 70-year-old win di election wit 37% votes inside a very tight contest, as each of di major candidates win 12 states each.
Opposition parties, di Peoples Democratic Party and di Labour Party no agree wit di results. Dem claim say wuruwuru dey for di election.
Di Labour Party presidential candidate, Peter Obi wey finish for third position for di elections, don promise to challenge do results for court.

- Inec declare Bola Tinubu winner of 2023 Nigeria presidential election
- Nigeria presidential elections 2023 results LIVE
- https://www.bbc.com/pidgin/articles/c2q922egkego

Ukraine
Ukraine President, Voldymyr Zelensky congratulate Tinubu as im declare say, e dey hope to work more with Nigeria to overcome global problems like food threats.
US congratulate Nigeria president-elect, call for calm
Di United States don congratulate Nigerian president-elect Bola Tinubu and citizens afta di just-concluded general elections.
Dis competitive election represent a new period for Nigerian politics and democracy. Di US State Department tok-tok pesin Ned Price tok for inside statement.
Di State Department wey however acknowledge di frustration among some Nigerians and parties on top di way di elections take go plus technical problems wey don fuel accusations of fraud.
End of Di one wey oda users dey read well well
E call on di electoral body to improve on di 11 March gubernatorial elections, as e note say Nigerians dey right to expect dem to do beta.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Di US also urge all parties to avoid "violence or inflammatory rhetoric for dis critical time" and seek to resolve any disputes through legal channels.
UK
Di UK Prime Minister Rishi Sunak for im congratulatory message say im dey look forward to work togeda wit di president-elect Bola Tinubu to grow security and trade ties.
Oga Sunak tweet say "Di UK-Nigeria relationship remain strong."
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Niger Republic
Di President of di Republic of Niger, Mohamed Bazoum also congratulate president-elect Bola Tinubu.
E say di free, democratic and transparent election reinforce di anchoring of democracy for Nigeria and im winning be great progress for di entire African continent.
Ghana congratulate President-elect Bola Tinubu
President Nana Akufo-Addo for im congratulatory message tok say Bola Tinubu victory for di polls don give di ruling APC goment, additional years for office wey e hope say go go a long way to enhance quality of governance, di rule of law and di performance of di Nigerian economy.
E say im expect di president-elect to continue for di path of past Nigerian leaders and even more make e make di friendship wey dey exist between Nigeria and Ghana deep.
For candidates wey lose for di election, President Nana say dia reactions to di result of di elections go reinforce di boundaries of Nigerian democracy.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 3
Republic of The Gambia
The Gambia president, Adama Barrow for inside short tweet congratulate di president-elect, Bola Tinubu for im win.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 4










