Likely issues Tinubu fit address for im first ever presidential media chat

President Bola Tinubu

Wia dis foto come from, Nigeria Presidency

Read am in 5 mins

All eyes and ears don dey ready to hear wetin Nigeria President Bola Tinubu go tok for im first ever Presidential Media Chat, wey go occur Monday night, on December 23.

Di media chat, according to one statement wey Bayo Onanuga, Special Adviser to the President on Information & Strategy, for di state-owned media houses, go occur for state-owned media dem, Nigerian Television Authority and Federal Radio Corporation of Nigeria.

Dis go be president Tinubu first media chat since im enta office for 2023.

Di year 2024 na tough year for Nigerians wey dey experience di worse kain of economic hardship since di history of di kontri, as di economy of di kontri wey bin dey stand on k-leg.

Di kontri pipo dey expect say, inside dis first ever media chat of President Tinubu wey bin enta office nearly two years ago, im go torchlight di plenty issues wey dey cause di pipo sufferness.

Some of di major concerns dey based on social, economic and political issues.

Economic issues

Nigerians don carry eye see sometin as di inflation rate for di kontri reach 34.6% for November, reducing wetin Nigerians fit buy wit di tachere money wey dem dey make per month.

One major economic mata wey dey everybody mind na di fuel pump price.

Nigerians wan know weda one day, one day, di price of fuel go come down, especially as e be say dis dey affect di high cost good and services.

Dem go also wan know wetin im don do, and wetin im dey do to make sure say youth unemployment go reduce. Dis na very important mata especially as e be say more and more pipo don loss dia work say of companies dey close down.

Following di reduction of onboarding cost by Dangote refinery and di completion of di Port Harcourt refinery, Nigerians don admit to drop in fuel process, as retailers say pipo go soon fit buy am for for 935 naira.

Na one major win for di kontri wey don dey suffer under di end of fuel subsidy for di beginning of Tinubu administration.

As im administration no get named pesin to head di ministry of petroleum, Nigerians dey torchlight wetin e go tok on top how prevent future hikes wey fit happun again.

Electric grid collapse

Di national grid don collapse more times dis year dan in recorded history, leaving many pipo in darkness for days and scattering frozen food businesses for di North of di kontri.

By November, di grid for don collapse a total number of ten times.

Many experts dey believe say old equipment, small capacity, and poor maintenance dey affect di power network, make light dey lose for transmission.

Heather Onoah, wey dey for GENCOs Board of Trustees explain say lack of transmission facilities na one of di main problems wey dey cause grid collapse.

Security

Insecurity for Nigeria dey grow every day, as orishirishi groups dey appear more and more to harass pipo.

Bandits dey kidnap plus sack pipo from dia villages, herdsmen and farmers continue to dey clash, armed jihadist groups like Boko Haram for north east and recently Lakurawa for north west, dey terrorise pipo.

Di insecurity for di kontri no allow farmers farm and dis don cause serious food scarcity for di kontri as cost of food skyrocket.

All of dis don add to di multidimensional poverty wey no allow di pipo breath.

For di 2025 budget, presido propose five trillion naira for security.

E no clear how dis go end insecurity for kontri wey recent NBS report show say pipo pay over two trillion naira as ransom to kidnappers between May 2023 to October 2024.

Stampede deaths

President Bola Tinubu cancel all im official events for Lagos in honour of di pipo wey lose dia lives for Abuja and Anambra stampede.

Im special adviser on media and strategy Bayo Onanuga yarn dis one for statement on Saturday 21 December.

President Tinubu urge states and relevant authorities to enforce strict crowd control measures immediately.

But former presidential candidate, Peter Obi, don blame di hustle to survive for dis kain sapa period as di reason behind di deaths of plenti pipo for stampede wey happun for Ibadan, Abuja and Anambra.

Di 2025 budget

Last week Wednesday, Tinubu drop im 2025 budget proposal give di National Assembly wey reach 49.7 trillion naira.

Tinubu bin list some of di highlights of di budget as defence and security go get N4.91tn, infrastructure go get N4.06tn, health go get N2.4tn, and education go get N3.5tn.

For di 2025 budget presentation joint session for di National Assembly Oga Tinubu tok say di economy dey respond positively to stimulus.

According to am, di reforms wey im administration start since im enta office don begin yield results.

But many criticism come on top di budget proposal head.

Nigeria Former Vice President Atiku Abubakar don throw shade to di 2025 budget wey President Bola Tinubu bin present on Wednesday.

Atiku point out say di poor execution of id 2024 budget, di high debt servicing percentage, di high level of repeat spending for goment, insufficient capital investment and regressive taxation na im make am no believe in di budget for next year.