IPMAN, MRS and NNPC new fuel price rate – price of fuel go kontinu to go down?

Fuel attendant dey sell fuel for customer for one filling station for Yaba, Lagos, Nigeria, on Saturday, July 29, 2023.

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 3 mins

Di price of fuel dey show signs say e fit begin come down for different parts of Nigeria afta Dangote Refinery and di Nigerian National Petroleum Company (NNPC) Limited reduce ex-depot price to 899 naira ($0.58) per litre.

Although dis price reduction neva spread to most filling stations yet, di National President of Petroleum Products Retail Outlets Owners Association of Nigeria (PETROAN), Billy Gillis-Harry, don give di kontri pipo assurance say pump price go drop witin di week.

For some months now, pipo for di kontri dey buy fuel for as high as 1,200 naira or more depending of which part of di kotri dem dey live.

On Sunday, di Independent Marketers Association of Nigeria (Ipman) bin say dem go begin sell di new pump price of 935 naira, based on di new arrangement wit Dangote.

Ipman National President, Mafandi Garima, bin say dis di ex-depot price wey Dangote reduce, plus di uniform arrangement wey dey ground na im make am possible for dem to reduce pump price.

But since di announcement of reduction in ex-depot price, some filling stations don reduce pump price.

Dangote Refinery for one special collabo wit MRS, don begin sell fuel to pipo all over for 935 naira per litre.

For di kontri capital Abuja stations like MRS and NNPC stations, don begin sell 965 naira per litre instead of 1,060 naira wey dem bin dey sell since dis month.

Oga Gillis-Harry say once dia members begin load petrol from "NNPC and Dangote for dis new price wey dem reduce, e go show for di market," im tell tori pipo Channels for Monday's edition of dia breakfast show Sunrise Daily.

E add say one reason why all dia members neva begin reduce price na sake of say dem, some of dem still get old stock.

"No forget say some of dem bin buy at 970 naira, dem pay transportation costs and logistics and dis carry am go up," Gilly-Harry say.

E say dem no fit sell at a loss, dat na why e go take small time for di new price to reflect.

Dis fit be di beginning of pump price reduction for Africa biggest economy? Na only time go tell.

Di new reduction go mean say cost of evritin for di economy go come down? Dat na difficult kwesion to ansa for kontri wia prices on a normal, dey evri go up but bo dey ever come down.