Former Leopards winger Ezekiel Otuoma die afta Motor Neurone Disease battle

Wia dis foto come from, @rachealotuoma/Instagram
Former AFC Leopards winger Ezekiel Otuoma don die at di age of 31 afta im battle wit Motor Neurone Disease (MND), wey be uncommon condition wey dey affect di brain and di nerves.
Otuoma wife Racheal confam di death for one social media post on Saturday morning.
"You leave a hole in my heart wey no one else fit fill. Di emptiness in my arms remind me of di love we bin share. Your love na gift and I go cherish am always.
She added: "It broke my heart to lose you but you didn't go alone, a part of me went with you. Till we meet again."
Dem bin diagnose Otuoma wit di disease for 2020, wey confine am to wheelchair.
Na di disease bin end im ogbonge career for di Kenyan Premier League.
According to Otuoma wife statement, di former footballer die on her birthday.
"Though na soon. Dat really break my heart as you leave on my birthday. E no go be di same again. You bin no tok say you dey leave or even show a sign. I love you dearly and in death I love you still, for my heart you hold a place wey be say na only you fit fill.
It break my heart to lose you but you no go alone, a part of me go wit you. Till we meet again," Racheal tok.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
AFC Leopards mourn dia former player on social media as dem tok sorry to im family.
"Ezekiel Otuoma don rest. Former AFC Leopards winger Ezekiel Otuoma "Rooney" don pass away. We pass our heartfelt condolences to im family and entire football fraternity. May im soul rest in eternal peace," dem write on social media.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Wetin be Motor Neurone Disease?
Motor Neurone Disease (MND) na one rare condition wey dey affect di brain and nerves. E dey cause weakness wey dey worsen ova time, according to NHS.
E dey affect mostly pipo for dia 60s and 70s, but e fit also affect adults of all ages.
Na one problem wit cells for di brain and nerves wey dem dey call motor neurones dey cause am.
Di cells go gradually stop to dey work ova time. Di reason why e dey happun neva dey known.
MND no get cure, but treatments dey to help reduce di impact e dey get on pesin daily life. Some pipo don live wit di condition for many years.
MND fit shorten life expectancy and e dey unfortunately eventually lead to death.
Symptoms of motor neurone disease dey happun gradually and e fit no dey obvious at first.
Di symptoms include:
- Weakness for di ankle or leg
- Muscle cramps and twitches
- Slurred speech, wey fit make am hard to swallow some kain food
- Weight loss β arms and leg muscles go become thinner ova time
- To stop yoursef from crying and laughing for some kain situations go hard.








