How much you go spend to travel dis festive season

Wia dis foto come from, IBOM AIR
We don enta di season wey pipo like to dey travel across di world to spend time with family and friends.
E no dey different for Nigeria, as na time wen pipo dey travel from different part of di country to different part of di country to celebrate.
But dis year, in line with how cost of living don sky rocket plus wetin cost of fuel dey tok, e dey expected say e go affect di cost of transportation.
For dis tori, we chook eye inside how much e go cost you if you decide to travel, weda by air, road or rail.
How much you fit spend by air
Tori be say crowd of pipo dey for airport dey wait to travel by air even though di prices of tickets get as e be.
Cost of flight tickets according to di website of major local flights for Nigeria dey cost between 143,000 t0 238,000 for Abuja to Lagos.
Odas dey charge between N95,000 to 290,000 for Abuja to Port Harcourt.
Anoda airline dey charge between N90,000 and N250,000 from Abuja to Uyo.
While anoda dey charge between 153,000 to 200,000 for Abuja to Enugu.
Kano to Abuja na between 95,000 to 150,000.
Note say dis na di prices wey show for dia website wen we check prices of tickets online.
Even with di hike in price, some passengers dey suffer flight delays and cancellations.
BBC Pidgin reach out to, one passenger Mr Ifetayo Adeniyi wey tok say di flight delays and cancellations don affect im work in di last three days.
Im explain say passengers too much and e dey affect di normal flight schedules of airlines wey dey lead to cancellations and delays dis period.
"My 4:00pm flight turn to 7:00pm , den 10:30 pm, na for night I enter Abuja, till now, I neva get mysef"
"I no return back to Lagos wit my 4:00pm flight, I buy anoda ticket wey dey available sharp-sharp, if not my work schedule go scata."
Meanwhile, most local airlines dey notify passengers about delays for dia websites sake of di crowd of pipo wey dey book flights dis period.
Some local airlines sef dey fully booked.
How much you fit spend by road
BBC Pidgin correspondent follow some transport companies tok, to know how much transport be dis period.
From Abuja to Lagos na N45,000 by Sienna car, Abuja to Enugu na between N47,000 to N50,000, while Abuja to Port Harcourt na between N50,000 to N55,000.
For northern part of Nigeria, inter state travel for Kano state neva increase.
From Kano to Abuja still dey N12,000, Kano to Zamfara na N8,000, while Kano to Sokoto na between N12,000 to N13,000.
Dis prices no dey permanent and e depend on wia you dey go and which transport company you dey use.
Di prices of transport for di yuletide season dey go up evri year but e be like say di prices increase well-well dis year 2024.
Dis increment no dey far from di triple increase in petrol prices wey Nigeria don see dis year.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
FG transportation bonanza for di festive period to help citizens
To help reduce di transportation wahala, Nigeria goment declare free transportation for pipo wey dey travel by road and train.
Na on 16 December, 2024 Nigeria goment, through di Minister of Information and National Orientation, Mohammed Idris, afta di Federal Executive Council meeting tell tori pipo say from 20 December, 2024 to 5 January, 2025 train services go dey free.
"Recall say e bin happun last Christmas and Sallah periods. And Mr President don also approve say dis year, from December 20 to January 5, free transport service go dey nationwide," im tok.
Oga Idris add say di free train service na sake of President Bola Tinubu desire to reduce di effect of high transportation costs for di most vulnerable Nigerians.
Nigeria goment bin also tok say free Compressed Natural Gas (CNG) buses dey available for pipo wey wan travel.
Na on 5 December, 2024 wey di Special Adviser to di President on Information and Strategy, Bayo Onanuga post about di CNG buses wey go be free for 40 days.
Oda interventions from Nigeria National Petroleum Company Limited (NNPCL) and di Independent Petroleum marketers to make fuel available still dey.
But di cost of road transportation and flight tickets dey high.










