Security checks for Murtala Mohammed Airport, wetin to sabi and avoid

Checkpoint for airpot wit man raising im hand and festus Keyamo on di left

Wia dis foto come from, Getty Images/FestusKeyamo

Read am in 4 mins

Di Federal Airports Authority of Nigeria (FAAN) don release measures wey go help stop corrupt practices by officials and how checkpoint go be for Murtala Muhammed International Airport (MMIA).

According to FAAN, di new resolutions wey come out of di high-level meeting wey dem get go ensure transparency during search for airport and identify which security officials suppose search passengers.

Wen di Nigeria Minister of Aviation and Aerospace Development, Festus Keyamo dey confam di new resolutions for how di airport go run, e say di decision go help stop harassment of travelers 'by various agencies of govment wey dey stationed for our international airports.'

Di minister say dis new decisions dey important sake of di different plenti complaints wey dem don receive and na time to act be dis.

According to di new airport rules now, joint inspection by security agencies go stop for airport.

Wetin di aviation authority agree on

  • Elimination of joint inspection tables

- FAAN order immediate dissolution of joint inspection tables by security agencies

- Transition to intelligence-based searches, scanners, and individual profiling.

- Development of dedicated area for camera-based passenger observation.

  • Streamlined Passenger Processing:

- DSS and Immigration Service personnel go now share counters to reduce checkpoints for outbound passengers to help travel flow.

- Customs go relocate to di AVSEC screening point for money declaration.

  • Transparency in Search Procedures:

- Wen passengers arrive, secondary screening go happun for a profiling room and di rooms go dey for Terminal 1 and 2.

- Real-time screens go dey installed for di profiling rooms to display di names, agencies, and contact details of officers wey dey duty to ensure transparency.

  • Redefining Agency Roles:

- NDLEA personnel go partner wit AVSEC for screening points and conduct roving checks for di arrival hall.

- DSS officers go waka round di departure and screening areas.

- FAAN order immediate activation of a mobile court wey go handle di prosecution of offenders, especially touts.

- Dem get a secure, convenient space for visitors awaiting arriving passengers.

  • Zero Tolerance for Misconduct:

- FAAN also say dem go begin immediate prosecution of any bureau de change or Car-hire staff wey dey waka anyhow or engage for unauthorized activities.

- Dem go also prosecute any bureau de change or Car-hire staff wey dey outside of di designated areas.

- Any businesses wey no comply go also face shutdowns and withdrawals of rights to operate for terminals.

- E go also get large signs to enforce a three-minute pickup rule and promote free WiFi for passengers.

Wetin go happun to flight cancellation

Di Issue of flight cancellations and delays without prior notice to passengers go soon end, Nigeria Minister of Aviation and Aerospace Development, Festus Keyamo tok.

Di minister also say di high prices of tickets for local and international flights dey give am concern, and im don begin find out wetin dey cause am.

For inside one exclusive interview wit BBC Pidgin, di former Minister of State for Niger Delta explain say, wetin dey cause di delays for flight, flight cancellations and high price of tickets, na sake of say di airline operators for Nigeria no get enof aeroplanes.

E say goment don start di process wey go give Nigeria airline operators power to do business wit foreign companies wey dey manufacture aeroplanes.