Wetin make goment relocate FAAN headquarters from Abuja go Lagos

Festus Keyamo

Wia dis foto come from, @fkeyamo/X

Nigeria Minister of Aviation and Aerospace Development, Festus Keyamo, bin order di relocation of di Federal Airports Authority of Nigeria (FAAN) headquarters from Abuja go back Lagos on 15 January 2024.

Di minister decision don dey make some Nigerians para for di last few days as many dey wonder wetin make di goment relocate di headquarters go Lagos.

For inside one statement wey FAAN release to explain dia reason, di Director, Public Affairs and Consumer Protection, Obiageli Orah, say Lagos na di original base for dis headquarters for many many years and na until recently dem bin carry am go Abuja.

For May 2020 di former Minister of Aviation under Buhari goment, Hadi Sirika, bin order all di agencies under di ministry to relocate dia headquarters go Abuja.

Inside letter wey Sirika bin write take give di order on 4 May 2020, e say di relocation na for two reasons:

Murtala Muhammed Airport

Wia dis foto come from, Getty Images

First to make dem obey one presidential order wey di Goodluck Jonathan goment bin don give di agencies since 2012 for dem to relocate dia headquarters go Abuja, and second, to reduce cost on goment.

Even though di agencies oppose Sirika order, dem move go Abuja despite say none of dem get office for Abuja.

FAAN for im recent statement say di pipo wey di decision to move go Abuja bin affect, don return to Lagos since becos dem no get one single FAAN building for Abuja wey go contain all of dem.

Di statement add say di wahala wit returning to Lagos be say, dem still gatz go work for Abuja, diafor di authority dey pay dem out of station allowance.

According to di agency, di “Minister don decide to stop dis waste of public resources.”

Anoda option wey bin dey available for dem na to abandon di big office wey dey here for Lagos, find money rent office space for Abuja wey go cost millions of naira, Orah add.

Di statement also say although di minister don promise say goment go build befitting office for dem for Abuja and Lagos, until e happun, dem go continue to manage dia old building for Lagos wey go fit accommodate all of dem.

Orah say Abuja office dey run for full capacity as dem no touch anytin dia, di only mata wey get k-leg na di wahala of moving dia headquarters but dis no affect dia Abuja operation.