Why Abia govnor appoint Sanusi, Okonjo-Iweala as members of Economic Council

Wia dis foto come from, Alex Otti, Ngozi Okonjo-Iweala, Muhammad Sanusi II
Govnor Alex Otti of Abia State don appoint Emir of Kano, Muhammad Sanusi II; di director-general of di World Trade Organisation (WTO), Ngozi Okonjo-Iweala, as members of im Economic Advisory Council.
Oda pipo wey dey di list include former director-general of di Securities and Exchange Commission (SEC), Arunma Oteh, Chidi Ajaegbu, George Agu, among odas.
One press statement from di Abia State goment tok say di council na part of di govnor effort to reposition di state economic sector.
Oga Otti during di inauguration of di council on Thursday, tok say im administration dey seek di guidance from di 19-member council.
Im express concern say di state economy don become fragile because of “economic sabotage”.
“Today, I dey delighted to announce di formation of di Abia Global Economic Advisory Council (AGEAC),” Oga Otti tok..
“Dis esteem group dey comprise of distinguished personalities from various fields, wey don agree to advise our administration on economic matters.”
Di governor of Abia State tok say di programme go reposition and rebuild di state as di economic pride of Nigeria.
End of Di one wey oda users dey read well well
Im add say di newly appointed members go bring wealth of experience and expertise for dia various sectors, enhancing di diversity and dynamism of di Abia State Global Economic Advisory Council.
“AGEAC dey integral to our strategic initiative for di economic revitalization of Abia State. Afta years of neglect, our goal na to rebuild and reposition our state as a leader in innovation and economic growth, both regionally and globally,” Oga Otti tok.
“We don plan to capitalise on our rich resources, entrepreneurial spirit, and strategic location.
“Di AGEAC go offer insights and recommendations on fostering innovation, attracting investments, forming robust partnerships, and enhancing our state economic resilience amidst global economic shifts.”
List of Abia Economic Advisory Council members
Arunma Oteh – Co-Chair
Muhammad Sanusi II – Co-Chair
Bolaji Balogun – Co-Chair
Victor Onyenkpa – Member
Ifueko Omoigui Okauru – Member
Chidi Ajaegbu – Member
Uche Orji – Member
Ndidi Nwuneli – Member
Chika Nwobi – Member
Olugbenga Adesida – Member
Ndubuisi Ekekwe – Member
Clement Owunna – Member
Uzodinma Iweala – Member
Ezinwa Okoroafor – Member
George Agu – Member
Uzo Nwankwo – Member
Chinedu Azodoh – Member
Ngozi Okonjo-Iweala – Honourary Advisor
Benedict Oramah – Honourary Advisor
AGEAC also include five members from di State Executive Council, wey include:
Dr. Alex Otti – Governor
Mr Ikechukwu Uwanna – Attorney-General and Honourable Commissioner for Justice
Mr. Kingsley Anosike – Honourable Commissioner for Budget and Planning
Mr Michael Akpara – Honourable Commissioner for Finance
Dr. Chimezie Isaac Ukaegbu - Honourable Commissioner for Trade, Commerce and Industry.
Di AGEAC Secretariat go dey under Mr. Chinenye Mba-Uzoukwu and Mr. Charles Egonye, wit support from Mrs. Victoria Onwubiko and Ms. Amaka Okonkwo.













