Bollywood star Saif Ali Khan out of danger afta dem stab am for im house

MUMBAI, INDIA - SEPTEMBER 10 : Saif Ali Khan attends the trailer launch of film 'Devara part 1' on September 10, 2024 in Mumbai, India. (Photo by Prodip Guha/Getty Images)

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Dem injure Saif Ali Khan for one midnight attack for im house
    • Author, Neyaz Farooquee
    • Role, BBC News, Delhi
  • Read am in 3 mins

Ogbonge Bollywood actor Saif Ali Khan don come out of surgery and out of danger afta one jaguda pesin enta im house, stab am plenty times.

Di attack happun early mor-mor on Thursday for one bigman area for Mumbai city, wia Khan dey live wit im family.

City police tell BBC Marathi say di actor bin wunjure for fight between am one man wey dem neva fit identify, for midnight.

Police don form teams wey go torchlight di mata.

"Khan don come out of surgery and dey out of danger. E currently dey recovery and doctors dey monitor im progress," Khan team tok for one statement.

Speaking to reporters afta di surgery, Dr Nitin Dange of Lilavati Hospital, wia dem admit Khan, say di actor "sustain major injury for im thoracic spinal cord sake of knife wey dem stab for im spine".

"Dem do surgery to remove di knife and repair leaking spinal fluid. Dem also repair two oda deep wounds for im left hand and one oda one for im neck by di plastic surgery team," im say.

Khan dey marry ogbonge Bollywood star Kareena Kapoor Khan and dem get two children. Di family neva make any public statements but im publicity team say dem dey okay.

E neva clear exactly wetin happun during di assault. Police say "unknown pesin" enta di actor home.

"After dat, Khan and di pesin egin argue," Mumbai Deputy Commissioner of Police Dixit Gedam tell BBC Marathi.

Khan team say na case of "attempted burglary" but no share more details.

"We request make di media and fans dey patient. Na police mata," dem say.

Who be Saif Ali Khan?

Khan, wey enta Bollywood for 1993, dey mainly work for Hindi cinema and dem sabi am for im quick wit and comic timing.

Among im popular movies na romantic comedies like Dil Chahta Hai and Kal Ho Naa Ho and recent action drama like Tanhaji and Devara: Part 1.

Im role as di antagonist for Omkara, one 2006 critically acclaimed or correct adaptation of Shakespeare Othello, bin totori pipo all over.

Khan come from family of former Nawabs wey rule Pataudi, one small princely state outside of Delhi, and im marry into family of film stars.

Im papa Mansoor Ali Khan Pataudi bin be cricket player wey bin captain India team for di 1960s.Im mama Sharmila Tagore na veteran actress wey bin act for some correct Hindi and Bengali films from di age of 14.

Im sister Soha Ali Khan bin also act movies for some years.

Khan wife Kareena come from family of celebrity actors, directors and producers wey don dey active for Bollywood for almost one hundred year.