I don tire to hear all dis plenty tok about black James Bond - Skepta

Skepta as Tribal Mark

Wia dis foto come from, 1Plus1

Wetin we call dis foto, For im first feem Skepta play di part of Tribal Mark one hitman wey dey work for di black secret service
    • Author, Yasmin Rufo
    • Role, BBC News

Rapper Skepta say im don decide to create one feem, about one black undercover secret service agent afta im “tire wit all di tok tok wey no get head about who go play di black James Bond."

For im tok about im new feem, Tribal Mark, Skepta tell BBC say im ready to make one anti-hero character for black actors.

Dis na di first time wey di 41 year-old artist wey im real name na Joseph Olaitan Adenuga, wey dem sabi as one of di pioneers of British grime music dey go into feem directing, producing and acting.

Im new short feem follow di journey of one Nigerian immigrant, Mark, wey go London as small pikin, come learn di new culture and way of life.

As a teenager im struggle to fit in, come end up for prison for possession of firearm.

Fast forward to di present day, and di Mark wey dress sharp inside suit – Skepta act as Mark – dey eat Nigerian dinner, pounded yam and Egusi soup.

Im introduce imsef for camera as: "I'm Mark. Tribal Mark", dey emphasize di famous line: "Di name na Bond. James Bond."

Speaking about wetin ginja am to do di feem film, Skepta say na about di "dissociation of one immigrant wey dey live for UK", sometin wey im bin fit relate to.

Dem born di musician wit Nigerian parents for Tottenham, north London, and na dia im grow up, but im sharply explain say dis biopic or history movie no be about im life.

"I no be hitman like Mark is," im add jokingly.

'More complex James Bond'

Di grime artist call Tribal Mark di start of im dream of wider cinematic universe wey go get black male leads.

E go base around one "hitman wey go work for di black secret service" wey go be "anti-hero character similar to James Bond - but more complex".

Im compare im short feem to 2019 Oscar-winning feem Di Joker, wey tell di back story of Batman nemesis, as im say im movie dey "show us how and why Mark become Tribal Mark".

Tribal Mark

Wia dis foto come from, 1Plus1

Wetin we call dis foto, Di team wey dey make di feem say dem hope e go "encourage cultural understanding and inspire resilience in youth"

Skepta say im want make "character for black actors" as im don "tire for di tok tok" over weda black actor fit play James Bond.

"E no go make sense if plenty white actors kontinu to dey ask say dem wan play Black Panther, becos im na black," im tok.

Di 007 agent, wey novelist Ian Fleming create, wey Daniel Craig recently act, na white actors don dey act time since e first hit di big screen.

Since Craig confam say im no act di part again for April 2020, pipo don dey wonder who go be di next persin wey go act di role and di question weda di pesin go be black actor common dis days.

Idris Elba bin be one of di names wey dem bin guess, but im recently tell SmartLess podcast di kain racist abuse im receive kuku "make di whole tin disgusting and off-putting".

Skepta

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Skepta hit music include Shut Down, Greaze Mode, What Do You Mean and Waze

Na Skepta own production company 1PLUS1 create dis short feem, and dis no be di first im dey show im capacity to DIY.

Im 2016 album Konnichiwa, wey win di Mercury prize and contain songs like That's Not Me, Shutdown and Man, na for im bedroom im bin record di whole tin and market am direnctly to im fans online, witout all feferitis of di modern music industry.

Di musician release anoda album since den for 2019, Ignorance is Bliss, and im feature am on ASAP Rocky Praise the Lord single wey enta chart of Billboard Hot 100.

One time, im bin tell BBC say di internet don "give plenty opportunities to pipo wey no fit wit big companies," come add say "DIY na di future".

As im dey try discover new industry talent, Tribal Mark dey feature 90% minority ethnic actors and production team.

Skepta on set

Wia dis foto come from, 1Plus1

Wetin we call dis foto, Most of di actors and production team come from ethnic minorities

Afta Black Lives Matter, major studios say dem go examine dia diversity practices again. However, one recent report from USC Annenberg find say dem still never fit produce feems from pipo of colour.

Jude Carmichael, wey play young Mark for di feem tell BBC say im hope say "young black audiences go fit see pipo we look like dem, and know know say e dey authentic becos na pipo like dem create am".

Skepta say im decision to move into making feem dey simple.

"For so long I don only make three-minute snapshots of songs and videos, but I tink to mysef, 'Why not we try and flesh dat one out?'" im tell BBC.

"I want to try and tell story wit as much of di real emotion as possible".

Im add say while im music videos na "are super fiction", im feem na sometin wey "everybody fit understand and relate to".

Co-producer of di feem, Adam Strawford, say di feem go "speak volumes to anyone wey dem no born for UK and gatz to adjust to life here".

Tribal Mark

Wia dis foto come from, 1 plus 1

Wetin we call dis foto, Di feem follow di journey of one nigeria migrant wey relocate go London

Describing imsef say im na "musician bifor anytin else" e no be surprise say im feem contain one new song, Diligent, from album wey im go soon launch, Knife and Fork.

Di song wey im bin call Gas Me Up bifor, cause kasala afta accuse say im artwork bin refer to di Holocaust as e bin show some men wey shave dia head, one of dem get di word "Gas Me Up" tattoo across im head.

Skepta don apologise since and agree to di potential for offence, but no discuss di mata again wen BBC ask am.

Im say one of di main tins wey dey jinja im song na food.

Plate of food

Wia dis foto come from, 1Plus1

Wetin we call dis foto, Skepta say food na big part of im culture and e show well well for im short feem

E describe food as one of di main elements for im culture, and say im new album na about "my grandad as im dey tell my mama say we must to do well and eat food wit knife and fork".

Di idea of knife and fork take my parents, and now I just wan eat wit my hands."

Food also appear well well for di feem and dem use am as way to show how Mark kontinu to dey connect wit im culture.

As im look towards Hollywood, Skepta dey hope im new movie franchise go dey as successful as im music career, and plan already dey ground for di first full length feem about Tribal Mark.

"We already dey tink about di kain car wey im dey drive, wetin im dey chop, how many languages im fit speak and which suit im dey wear. We dey really get into am."