Who be General Asabuja wey police declare wanted for Rivers State?

Foto of Asabuja wey police declare wanted

Wia dis foto come from, Asabuja/Facebook

Police authorities for Rivers State declare a former Niger Delta militant leader Gabriel ‘General’ Asabuja wanted.

Di Commissioner for police Tunji Disu tok so for one televison program as e dey address di political crises wey dey shele for di State.

Dis one dey follow viral video wia Asabuja bin dey make some strong comments about di local goment council crisis wey dey rock di fragile Southern state.

CP Disu condemn di action, say, “dat video cause a lot of panic for di state. E give a lot of concern to evribodi even outside di state. I wan to assure una say we no go take kindly to dat.

"We dey look out for am. Im dey wanted, dat wan dey correct,” na so CP Disu tok.

Political crisis dey rock di oil rich Rivers State since late last year sake of fight fight between govenor Siminialayi Fubara and im di former govnor Nyesom Wike.

Di latest na di crisis over di leadership of local goment councils.

Di tenure of chairpesins, dia deputies, and councilors end on 17 June, 2024 wey make Governor Fubara to swear in a caretaker committee.

But dis move no go down well wit Wike loyalists wey say di governor action dey wrong and sake of dat, dem don do protest.

Who be General Asabuja?

General Asabuja, also known as Gabriel ‘General’ Asabuja, na former Niger Delta militant leader wey bin be di head of operations of di Movement for the Emancipation of Niger Delta (MEND).

Dem born am for Rukpakulusi, Obio Akpor LGA of Rivers State and e presently be di second in command to Asari Dokubo. E describe imsef as a youth leader for di Niger Delta region.

For di viral video wey di Police Commissioner refer to, General Asabuja declare support for di govnor as against former local goment chairmen for di State wey say dem still dey in office even afta 17 June, 2024 wey dia three year tenure end.

E say e don send im ‘soldiers’ to guard di 23 council secretariats and dem ready to face anybodi wey wan come for dem.

A protester in Asaei Toru
Wetin we call dis foto, Protests don hold for Asari Toru, Port Harcourt, Tai, Obio Akpor and Gokana LGAs

Afta di tenure of local council chairmen for Rivers State end on Monday 17 June 2024, police operatives take over council secretariats for di 23 LGAs.

Dem say na dia way to avoid breakdown of law and order.

Di Police blockade no allow local goment workers to enta dia offices and even di newly sworn in Caretaker Committee Chairmen wey govnor Fubara appoint.

Sake of dis, labour unions and local council workers say dem go protest make police allow workers enter dia secretariats do dia work but dem later cancel di protests.

Police authorities say dem no go comot from di LG Council Secretariat until Court of Appeal decide mata wey dey bifor dem.