Rivers crisis kontinu as police declare govnor chief of staff, odas wanted for alleged terrorism, murder charges

Newspaper publication

Wia dis foto come from, Nigerian Police Force

Wetin we call dis foto, Nigerian police declare Edison Ehie , five odas wanted

Di Nigerian Police Force don declare di Chief of Staff, Rivers State Goment House, Edison Ehie and five odas wanted.

Dem declare di six pipo wanted over dia alleged connection to di burning of Rivers State House of Assembly complex and oda allegations wey bother on di murder of DP Bako Angbashim and Terrorism.

Di oda five pesins na Jinjiri Bala, Happy Benedict, Progress Joseph, Adokiye Oyagiri and Chibuike Peter, also known as Rambo.

But Ehie immediately approach a State High Court for Port Harcourt and e grant injunction against im arrest by di police.

Ehie for di application, ask di court to stop di police and any oda security agencies from arresting, detaining and harassing im over im alleged involvement in di burning of di Rivers assembly complex.

Di judge Justice Sika Aprioku, grant di application before e adjourn di matter to 6 February for hearing.

Edison Ehie

Wia dis foto come from, Edison Ehie

Wetin we call dis foto, Edison Ehie bin be a factional speaker of di RSHA before e resign to become Chief of Staff

Meanwhile an Abuja Federal High Court, no gree to quash di terrorism charges against five loyalists of govnor Siminalayi Fubara of Rivers State.

Di Judge say di charge sheet only indicate say Ehie dey at large and no dey listed on di charge as required by law.

Presiding Judge, Justice Mobolaji Olajuwon declare say di court no go strike out di charges as Edison Ehie di current Chief of Staff to di governor ask.

Di court hold say Ehie, wey be di bifor-bifor factional Speaker of Rivers State House of Assembly, lack legal powers to request for dismissal of di charges.

Justice Olajuwon uphold di submission of di counsel to di Inspector General of Police, IGP, Simon Lough SAN say Ehie no dey competent to make any application until e appear in court to take im plea for di terrorism charges.

Ehie, through im lawyer, Oluwole Aladedoye SAN, bin don apply make dem drop di criminal charges against im and odas on various grounds.

E claim say di Federal High Court in Abuja no get jurisdiction to entertain di trial becos di alleged offences dey committed in Port Harcourt, Rivers State.

E also claim say e no dey indicted by di police for any offence.

But di court oppose di request on di ground say Ehie neva appear before di court to take im plea.

Di police lawyer cite Section 396 of di Administration of Criminal Justice Act ACJA 2015.

For di brief ruling, Justice Olajuwon dismiss di request of di former Speaker and uphold di arguments of di IGP.

E advice di Chief of Staff to either surrender imself to police or appear in court to take a plea before e fit qualify to make any application.

All di wahala start on di morning of Monday 30 October 2023, tori be say di Rivers State House of Assembly wey Speaker, Martins Amaewhule preside over resolve to serve govnor Fubara notice of impeachment as dem suspend four oda members indefinitely.

Di four members na Sokari Goodboy Sokari, wey dey represent Ahoada West, Adolphus Oruibienimigha, wey represent Opobo/Nkoro and Victor Oko Jumbo, wey dey represent Bonny and Edison Ehie, wey dey represent Ahoada East constituency II as Members of di House.

For statement wey Head of Communication, Rivers State House of Assembly, James Sogulu sign, for di 84th Legislative Sitting on Monday, 30 October, 2023, e say di Assembly resolve to serve a notice of Impeachment on di govnor of di state.

Presenting di notice of impeachment, di member wey dey represent Omuma constituency, Sylvanus Nwankwo say dem bring di notice of impeachment pursuant to Section 188 of di Constitution of di Federal Republic of Nigeria as amended, and add say di impeachment notice dey based on gross misconduct in di performance of di functions of di office of di governor.

Shortly after dis one happen, Governor of Rivers State Sir Siminialayi Fubara with some Assembly members like Edison Ehie, Sokari Goodboy Sokari and Victor Oko Jumbo go visit di State Assembly Complex to see di level of damage wey di fire outbreak cause but some police personnel wey bin dey guard di Assembly Complex open tear gas and water canon on am and some youths wey bin also follow di governor go di complex.