How Congress go certify Trump electoral college win?

File image inside di US Capitol wit one inscription for di wall wey read: "In God we trust"

Wia dis foto come from, Getty Images

    • Author, Ana Faguy
    • Role, BBC News, Washington DC
  • Read am in 4 mins

US lawmakers go on Monday 6 January gada for one joint session of Congress to certify Donald Trump presidential election win.

Na one procedure wey dey happun evri four years afta di vote and two weeks bifor di president inauguration.

Di last time wey e suppose happun, di routine bin no go well as one group of Trump supporters bin riot for di Capitol to try to stop di formal vote-counting and overturn im defeat for di 2020 election.

Dis year certification go bring Trump one step closer to di White House, afta di Republican win di 2024 contest against Democratic Vice-President Kamala Harris.

Sake of her role as leader of di Senate, Kamala Harris go oversee di certification.

Wetin dey happun during di certification?

Federal law say Congress gatz gada on 6 January to certify di election results.

Members go open sealed certificates from America 50 states, each of which contain one record of dat state electoral votes.

Di lawmakers go read out loud di results and official count go dey tallied.

Di president of di Senate - currently Harris – go preside ova di joint session of Congress. She go formally declare di winner of di presidential election.

Wetin happun di last time?

Di routine bin turn violent on 6 January 2021: di last time dem hold joint session of Congress to certify election results.

Afta Trump claim say dem tiff 2020 election from am, hundreds of rioters bin climb through barricades to try stop di certification of Joe Biden win.

Trump bin ask Mike Pence, wey be di vice-president den, to gada "courage" and allow states to "correct dia votes".

Di crowd later full and empty di halls of di US Capitol building, members of Congress later return and certify di election, and Pence reject Trump request. Dem blame di several deaths wey happun dat day on di violence.

Since den, Trump and many of im supporters still maintain im baseless claims about di 2020 election. E don promise to pardon some of dose wey dey convicted of offences ova di riot wen e return to di presidency.

Wetin go likely happun dis year?

While some lingering anxiety still dey for Washington DC, dis year certification dey expected to go off witout wahala, and Harris sef no disagree wit di results.

Dis no be di first time wey election candidate wey lose go oversee di certification process.

For 2021, Pence bin oversee di certification of di Biden-Harris victory, and for 2001, den-Vice-President Al Gore bin oversee di certification of President George W Bush.

Congress member fit object di results?

Short answer: yes. But e no dey happun most of di time.

Members of Congress dey allowed to object afta dem read out one state certificate. But in order for di presiding officer to hear di objection, one-fifth of di members of di House (di lower chamber) and one-fifth of di Senate (di upper chamber) gatz write and sign am.

Bifor now, na only one member from each chamber need to raise di objection.

Di new policy bin take effect for 2022, inside one attempt to make objections more difficult.

If one objection no meet di new requirements, dem go suspend di joint session for di House and Senate to consider di objection separately. Both chambers go gatz reach a majority vote for di objection to dey sustained.

For 2021, di House and di Senate bin reject di challenges to electoral votes for Arizona and Pennsylvania.

Wetin go happun next?

Once di certification don complete, na only one step remain for di process bifor Trump go officially be president again: di inauguration.

On 20 January, di Trump family, former presidents and members of di public go gada on di west front of di Capitol for di official swearing in of di 47th president.