Nathaniel Bassey, odas wey go perform for Donald Trump inaugural prayer breakfast

Wia dis foto come from, Nathalie Bassey/ Instagram
Nigerian gospel minister, Nathaniel Bassey go perform for di US Presidential Inaugural Prayer Breakfast on 20 January, 2025. Dis na on di morning of di inauguration of president-elect Donald Trump.
Di non-political and faith-based event go hold for Waldorf Astoria Presidential Ballroom, Washington DC in honour of President-elect Donald Trump and Vice President-elect JD Vance bifor dia swearing-in ceremony.
Na Reverend Merrie Turner be di host of di prayer breakfast.
Odas wey go perform for di event na Pastor Mario Bramnick, Revivalist Rebecca Macchi and Dr Dominiquae Bierman.
Nathaniel Bassey wey be di only Nigerian and African artiste confam im invite ontop im Instagram page on Sunday.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
Di event wey dey hold evri four years for new administration in di United States, na time for members of di congress and president to gada to offer prayers as support for di incoming leadership in di kontri.
Pastor Nathaniel Bassey dey hold im music and worship program, "Hallelujah Challenge" online to connect Christians worldwide and dis don earn am global recognition.
Di Nigerian born gospel artiste dey popular among oda artistes wey dem dey celebrate globally.
In 2024 Mayor of Albany, New York, Kathy Sheehan, honour Bassey by declaring 6 October as "Pastor Nathaniel Bassey Day".
Nathaniel Bassey profile

Wia dis foto come from, nathanielbassey.com
Nathaniel Bassey for im profile refer to imsef as pastor. But im dey popular as a gospel artiste wey come from Akwa Ibom State, Southern Nigeria.
Im na also recording artiste, trumpet player, singer and songwriter, and music producer. Im dey sing different styles of gospel music.
Oga Bassey na di Youth Pastor for RCCG, The King's Court wey dey Lagos.
Bifor im start to do gospel music, Nathaniel Bassey bin dey among di Steve Rhodes Jazz orchestra – im na dia bandleader.
Im bin also dey among di Spectrum 4 jazz quintet, and many oda musical bands.
Na for 2017 e start im 'Hallelujah Challenge', a praise and prayer session wey dey happun ontop social media. Many pipo dey join di challenge wey dey mostly start for night.
Nathanial Bassey dey married and e get two children.
Im get many songs wey e don wax and e don feature gospel musicians for Nigeria and abroad.









