Faces and names of some of di victims of Texas flood wey kill ova 100 pipo

Composite image show di faces of Renee Smajstrla, Jane Ragsdale, Julian Ryan, Sarah Marsh, Hanna and Rebecca Lawrence, and Jeff Wilson
Read am in 8 mins

Di heavy rain wey bring destruction to one children summer camp plus oda holiday spots for rural Texas bin come wit devastating speed.

Water bin crash through di stone cabins of Camp Mystic for di early hours of Friday, 4 July wit little warning as di girls and staff dey sleep.

Di banks of di Guadalupe River burst afta months of rain fall in just a few hours, one freak weather event wey officials describe as a "100-year catastrophe".

Authorities don confam say more dan 100 pipo don die across di state.

Camp Mystic, one Christian all-girls' summer camp, don confam say at least 27 girls wey bin dey camp and staff dey among di dead. Ten girls and one camp counsellor still dey miss.

Water tear through di green-roofed cabins, e leave plenty rubbles behind and take lives as young as eight years old.

Di White House meanwhile don reject suggestions say budget cuts for di National Weather Service (NWS) fit be part of wetin affect di disaster response.

At least 84 of di victims - 56 adults and 28 children – die for Kerr County, wia heavy rainfall make di Guadalupe River burst bifor daybreak on Friday, di July Fourth public holiday.

Di county sheriff office tok say dem neva fit identify about 22 adults and 10 children.

Scene of di devastating flood

Faces and names of some of Texas flood victims

Camp Mystic

Young attendees and staff for summer camps dey among di victims of flash floods for Texas - plus teachers, one football coach, and one "hero" father wey smash open one window to free im family for di middle of di rising water.

US media say relatives don identify many of di victims. Here na wetin we know so far about those wey dem name - many of dem be children.

Renee Smajstrla

Renee Smajstrla for Camp Mystic on Thursday

Wia dis foto come from, Camp Mystic

Camp Mystic na nearly one century-old Christian summer camp for girls on di banks of di Guadalupe River near di community of Hunt.

Na di generations of one family dey operate di camp since di 1930s. Di camp website describe di place as place for girls to grow "spiritually" in a "wholesome" Christian atmosphere "to develop outstanding personal qualities and self-esteem".

But just bifor daybreak on Friday, di Fourth of July public holiday, di river bin rise to 26ft (8m) in about 45 minutes for di middle of one heavy downpour.

Many of di hundreds of girls for di camp bin dey sleep for one low-lying cabins wey dey less dan 500ft (150m) from di riverbank.

Renee Smajstrla, 8, bin dey di camp wen floodwaters sweep through, her uncle tok for one Facebook post.

"Dem don see Renee but no be for di outcome we pray for," Shawn Salta write.

"We dey thankful she bin dey wit her friends and she bin dey get di time of her life, as evidenced for dis foto from yesterday," e write. "She go forever dey live her best life for Camp Mystic."

Lila Bonner

Dem find Nine-year-old Lila Bonner, one Dallas native dead, afta di flooding near Camp Mystic, according to NBC News.

Sarah Marsh

Sarah Marsh

Wia dis foto come from, Camp Mystic

Sarah Marsh, na one student for Cherokee Bend Elementary School for Alabama, she suppose enta third grade for August.

She, too, bin dey attend Camp Mystic and her grandmother, Debbie Ford Marsh, bin post online to say her granddaughter dey among di girls wey die.

Hanna and Rebecca Lawrence

Hanna (left) and Rebecca

Wia dis foto come from, John Lawrence

Twin sisters Hanna and Rebecca Lawrence, 8, also die afta dem attend Mystic, dia grandfather tell Miami Herald.

Bed and bunks scata everywia for Mystic camp

Wia dis foto come from, RONALDO SCHEMIDT / AFP

Wetin we call dis foto, Bed and bunks scata everywia for Mystic camp

Oda victims wey dem don identify include:

  • Anna Margaret Bellows
  • Mary Kathryn Jacobe
  • Linnie McCown
  • Hadley Hanna
  • Mary Stevens
  • Lainey Landry
  • Dick Eastland
  • Chloe Childress
  • Jane Ragsdale
  • Julian Ryan
  • Katheryn Eads
  • Jeff Wilson
  • Reece and Paula Zunker
  • Blair and Brooke Harber
  • Bobby and Amanda Martin
  • Tanya Burwick
  • Sally Sample Graves
  • Kaitlyn Swallow
  • John and Julia Burgess
  • Mollie Schaffer
Wetin we call dis Video, 'E dey very traumatising' - Kerrville local reacts to flood devastation

Why di Texas floods bin dey so deadly

As search continue for those wey still dey miss, pipo dey ask questions weda dem for don do more to prevent such ogbonge loss of life.

Experts tok say some factors dey wey contribute to di tragedy including di extreme weather, di location of di holiday homes and timing.

Large supply of moisture bin dey for di atmosphere from one tropical storm wey bin cause flooding for Mexico and den track north as e die out.

Kerr County, wia di camp dey located and wia 84 lives dey lost, na a hillier part of Texas, pass di surrounding counties. Dis one mean say di air wey get plenty moisture bin dey forced upwards, building huge storm clouds.

Kerr County na di heart of di Texas Hill Country, one popular holiday destination sake of im scenic rolling hills, countless rivers and lakes, plus an abundance of wineries.

But wahala dey too – sake of di continuous threat don destroy local communities ova di years, di region also dey known as "Flash Flood Alley".

For those early hours of Friday, di rain bin no fall heavily on di hills but e heavy for surrounding rivers, wey cause dem to rise at a fast rate.

Plenty water fall downstream, sweeping di low-lying area next to di river very quickly.

Di influence of climate change no fit dey ignored as anoda factor for extreme weather events like dis.

While e dey difficult to directly attribute di influence of di warming planet to one particular weather event, sea surface temperatures for di Gulf of Mexico, wia some of di air bin originate from, continue to dey warmer dan normal.

Warmer waters mean more evaporation and so more available moisture for di atmosphere to feed a storm.

Di year 2024 na record-breaking year for dis phenomenon, according to Copernicus Climate Change Service, e mean more "fuel" for extreme rainfall events.

Climate scientists continue to remind us say such rainfall events as we see for Texas go become more frequent and more extreme as di planet dey warm.

Authorities quickly issue early warning signs to stop di disaster?

Drone view show flooded houses, afta one heavy rains wey unleashed flash floods

Wia dis foto come from, Reuters

Questions don rise about if authorities provide adequate flood warnings and why dem no evacuate pipo ahead of di flood.

Judge Rob Kelly, di top elected official for Kerr County, tell CBS say di severity of di flooding dey unexpected.

"We no get any reason to believe dis go be anything like wetin happun for here. None whatsoever," Kelly tok.

Di first hint of di devastation to come bin appear on Thursday morning as rain and thunderstorms soak some central Texas counties.

Di National Weather Service (NWS) bin issue one common warning dem call flood watch at 13:18 dat afternoon for parts of di region, including Kerr County.

For di early hours of Friday, di outlook become more serious as di NWS issue series of upgraded warnings. Di San Saba river, di Concho River and di Colorado River bin dey rise.

Within di space of 45 minutes, di Guadalupe River don rise by 26ft (8m), wey cause di banks to burst.

On Wednesday, 2 July, di Texas Division of Emergency Management (TDEM) bin activate state emergency response resources sake of "increased threats of flooding for parts of West and Central Texas"

On Thursday afternoon, di National Weather Service (NWS) bin issue flood watch wey highlight Kerr County, central Texas, as place wey get high risk of flash flooding overnight

At 01:14 local time (06:14 GMT) on Friday, authorities issue flash flood warning for Kerr Country

At 04:03 local time (09:30 GMT) dem issue emergency flash flood warning for Kerr County, followed by anoda for di Guadalupe River at 05:34

By Saturday evening, at least 51 pipo don die, including 15 children.

For one news conference on Sunday 6 July, Governor, Greg Abbott tok say pipo for Texas dey used to flash flood warnings.

"But expectation no dey say di water wall go rise to almost 30ft high," e add.

Wetin we call dis Video, Watch: Dem ask Kerrville official about lack of flood warnings

What next?

President Donald Trump don sign one major disaster declaration on Sunday for Kerr County, and e activate di Federal Emergency Management Agency to Texas. E also say im go probably visit di state on Friday.

"We dey work very closely wit representatives from Texas, and na horrible tin happun, absolutely horrible," Trump tok on Sunday for New Jersey.

On di ground, local residents dey step up to support relief efforts - dem dey collect supplies, offer shelter, and dey do wetin dem fit do to help neighbours displaced by di storm.

Meanwhile, well wishes dey pour in from around di world.

For Rome, Pope Leo XIV bin offer special prayers on Sunday for di bereaved for Texas.

"I go like to express sincere condolences to all di families wey lost dia loved ones, in particular dia daughters wey dey for summer camp, for di disaster wey di flooding of di Guadalupe River for Texas for di United States cause," di pontiff tok.

"We pray for dem."

Get in touch

Have you been affected by flooding in Texas? Please get in touch if it is safe to do so.