Endometriosis and immune diseases get link - study show

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Galya Dimitrova
- Role, BBC News
- Read am in 3 mins
Women wey get endometriosis get even higher risk to develop orishirishi autoimmune diseases, na so one new research show.
Dis new study wey involve some researchers from University of Oxford, identify some important genetic link between conditions like rheumatoid arthritis, coeliac disease and multiple sclerosis to endometriosis.
E say endometriosis and dis autoimmune, autoinflammatory, and mixed-pattern diseases dey share di same biological process and features.
For dis reason, women wey get endometriosis, go later fit develop any one of dem.
But di study to tok weda dis group of women, fit get more dan one of dis oda diseases later in life.
Di study show say, women wey dey suffer endometriosis bin get 30-80% more risk of developing autoimmune diseases.
Di research team say dem fit use di new information "to look for new kain of treatment wey fit work across dis conditions".

Wia dis foto come from, Getty Images
Endometriosis na condition wia, di kain special cells wey dey di lining of woman womb begin grow for oda parts of di body.
For UK alone, dis condition dey affect about 1.5 million women.
Symptoms of endometriosis include very serious menstrual pain and extreme tiredness.
Di study use data from UK Biobank to analyse more dan 8,000 endometriosis cases and 64,000 clinical disease cases.
Di sabi pipo wey do di research bin torchlight how endometriosis dey behave wit 31 different immune conditions.
Di findings also suggest make women wey dey suffer endometriosis dey always go hospital for close monitoring so dem go fit quick catch di development of any immunological conditions.
Prof Krina Zondervan, joint senior author and head of Nuffield Department of Women and Reproductive Health for University of Oxford, say dat kain very big studies bin provide "valuable new understanding into disease biology".
"In dis case, we don give solid evidence say e get link between endometriosis and later risk of suffering diseases like osteoarthritis and rheumatoid arthritis, and we don show say dis one get biological basis," she say.
"We fit take advantage of dis new informate to look for new ways of treatment wey fit work on all dis different conditions."
Di team say di understanding "open up exciting possibilities" for new therapeutic approaches, such as drug repurposing or di development of combined treatments.
Na Wellbeing of Women UK bin provide di main fund for di research.
Chief executive Janet Lindsay say dis na "important step" in building more accurate understanding of endometriosis.
"For too long na only small investment dey come to research into women health issues like endometriosis," she say.
"E dey important for us to increase research investment for di next generation of women health researchers to expand our knowledge and improve patient outcomes."
You fit read di full paper for di Human Reproduction journal.










