Court order EFCC to release Aisha Achimugu within 24hours

Aisha Achimugu

Wia dis foto come from, EFCC

Read am in 4 mins

Di Federal High Court for Abuja don order di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) to kiakia release business woman Aisha Achimugu who dem bin arrest on Tuesday.

Justice Inyang Ekwo give di order dis Wednesday as di EFCC carry madam Achimugu come court on top accuse of fraud.

Rememba say di EFCC bin declare Achimugu wanted in March sake of accuse criminal conspiracy and money laundery.

Justice Ekwo bin give order say make Achimugu present hersef to EFCC on Tuesday, and come to di court dis Wednesday.

Achimugu hersef don also file case for court against di EFCC, DSS, Nigeria Security and Civil Defence Corps, di Nigeria Police and di Nigeria Immigration Service for violating her human rights.

As di hearing wan start, Justice Ekwo call both di EFCC lawyer and Achimugu lawyer inside im chamber make dem tok.

As dem come out, di trial judge say based on di affidavit of facts wey Madam Achimugu don file, di EFCC don grant her administrative bail, and dem go ratify am within 24hours

Both parties go come bak to di court on Friday, May 2 to follow up on di matter.

Aisha Achimugu dey answer kwesions for EFCC custody

Aisha Achimugu

Wia dis foto come from, Aisha Achimugu/Instagram

Nigeria corruption police di Economic and Financial Crimes Commission on Tuesday confam say Aisha Achimugu dey dia office.

Tori be say Aisha land Abuja on Tuesday morning from London to appear bifor di EFCC sake of fraud allegations and Court order.

While anoda tori pipo say EFCC bin arrest Aisha Achimugu as she land for Abuja Airport. Dem say na her lawyer give dem di tori.

According to local media na inside statement on Tuesday wey her legal team tok say EFCC arrest her afta she voluntarily come Nigeria from London.

Reports say na early mor-mor on Tuesday EFCC gbab her. Di anti-corruption agency neva tok if she waka go dia office by hersef or if na dia officials arrest her.

Local media dey report say di Federal High Court Abuja, bin give order on Monday say make she showface for EFCC office on Tuesday for interrogations.

Di Federal High Court also say she must showface for court on Wednesday, 30 April 2025, so dat dem fit continue to hear di mata.

Dr Mrs Aisha Sulaiman Achimugu, na Nigerian-born industrialist and humanitarian. She also be business woman.

EFCC bin declare di popular socialite and managing director/CEO of Felak Concept Group, wanted

For one circular wey EFCC bin post for dia social media accounts on Friday, 28 March, di commission say Achimugu dey wanted for alleged criminal conspiracy and money laundering.

Wetin bin happun for court on Monday

On Monday Justice Inyang Ekwo of di Federal High Court, Abuja, bin give order make Aisha Achimugu appear bifor di EFCC on Tuesday, 29 April, 2025, to ansa kwesions as dem dey chook eye for di mata.

Di judge also give order say, Aisha must show face for court on Wednesday, 30 April, 2025.

For statement wey EFCC spokesperson, Dele Oyewale bin release, court give di order sake of suit wey Aisha Achimugu bin file against different law enforcement agencies.

Di agencies wey she file suit against na di Nigeria Police Force, di Independent Corrupt Practices and Other Related Offences Commission, ICPC, di Department of State Services, DSS.

Odas na di EFCC, di Nigeria Security and Civil Defence Corps, NSCDC, and di Nigeria Immigration Service, (NIS).

How EFCC and odas respond

Di EFCC lawyer, Ekele Iheanacho, tell di court about one counter-affidavit wey one of dia investigators, Chris Odofin, give wia e tok about why dem dey invite.

For di affidavit, Odofin bin tok say Achimugu dey under investigation for alleged conspiracy.

Im add say she collect money by false pretense, money laundering, corruption and possession of property wey dem suspect tosay she get thru unlawful means.

Di Commission say Achimugu bin don honour dia invitation bifor on 12 February, 2024.

EFCC explain say she bin write statement dat time and dem give her administrative bail thru her lawyer and surety, Darlington N. Ozurumba.

Afta di bail she allegedly no gree showface again as dem bin agree, she instaed file fundamental rights enforcement suit against di EFCC.

According to di affidavit, Achimugu, for her statement, bin explain how N8.71 billion enta her corporate bank accounts as "investment fund" to buy oil block.

She bin claim say dem bin transfer di money to di Federal Goment account thru her company, Oceangate Engineering Oil and Gas Limited.

She bin also reference di documentation from di Nigerian Upstream Petroleum Regulatory Commission.

EFCC add say afta investigation, di affidavit, show say Aisha Achimugu company bin actually buy two oil blocks, Shallow Water PPL 3007 and Deep Offshore PPL 302-DO for di price of $25.3 million.

Investigations bin show say payments dem allegedly pay in cash thru bureau de change operators and dem no fit trace di ultimate source of di money to any legitimate business income or partnerships.

Di Commission also allege say di process wey dem use buy di oil wells dey corrupt. EFCC add say even though dem buy di two oil blocks, non of dem don start production wen di investigation bin dey go on.

According to EFCC di new suit wey Aisha Achimugu file current na to frustrate di investigation wey dey go on.