Fame dey lower life expectancy for musicians - study

Silhouetted back of band performing on stage in front of a large crowd

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Famous musicians risk lower life expectancy, one new study show
    • Author, Harry Sekulich
    • Role, BBC News
  • Read am in 3 mins

Fame fit reduce di life span of musician life, one new study don discover, afta e compare data between famous singers and less well-known artists.

Stardom fit shorten lives by 4.6 years, according to research wey Journal of Epidemiology & Community Health publish.

Previously, dem bin discover say touring, performing, and rock'n'roll lifestyles fit lower life expectancy for musicians.

However, di new analysis show direct link between fame and mortality for di first time.

Researchers from di University Witten Herdecke wey base for Witten, Germany, bin examine di data of 648 singers, half of whom dem establish say dey famous and di oda half less famous.

Dis data get di mixture of solo artists, lead and back-up singers for inside band.

Dem select di famous stars from di top 2,000 Artists of All Time, one list wey di ranking website Acclaimed Music collate.

The Beatles, Bob Dylan, plus di Rolling Stones, David Bowie, and Bruce Springstein bin dey di site top five most recognised names.

Di academics match each famous singer to one less famous one, wey dem pair up based on dia characteristics like gender, nationality, and genre of music.

Dem find out say famous singers dey live to an average age of 75 while less famous singers dey live up to 79.

"Di increased mortality risk associated wit fame dey comparable to oda well-known health risks like occasional smoking," di authors write.

By isolating fame as a risk factor, di study show say achieving stardom fit be "turning point" in bringing about greater health concerns.

Solo artists also carry higher mortality risk, di study discover, compared wit singers wey fit turn to band members for "emotional and practical support".

Dem list loss of privacy, intense public scrutiny, and performance pressure as contributing factors, although di study note say e no dey conclusively linked.

"Being famous na important factor wey dey influence longevity and e underscore di need for targeted interventions to mitigate its detrimental effects on longevity."

Di study however no dey gender balanced, 83.5% male to 16.5% female.

"Live fast, die young" lifestyles fit be di focus of previous research into mortality risks wey dey associated wit fame, including greater chance of drug and alcohol abuse.

Pop stars wey experience fame between di ages of two and 25 dey two to three times more likely to experience risks of mortality compared to di general population, a US-based study found in 2007.

Popular culture don make reference to di 27 Club, wey dey made up of rock stars wey die at di age of 27, wey include Amy Winehouse, Jimi Hendrix, Janis Joplin, Jim Morrison, Kurt Cobain, and Brian Jones.

For 2011, a study published in the British Medical Journal bin conclude say no heightened risk of death for famous musicians for di specific age of 27, instead dem discover say young rock stars "generally get increased risk throughout dia 20s and 30s".

In recent years, di deaths of young popular artists like rapper Mac Miller (26), DJ Avicii (28), and One Direction Liam Payne (31) don leave dia fans and loved ones devastated.