Who be di 'third world countries' Trump say im go permanently pause dia migration to US?

Donald Trump

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 4 mins

US President Donald Trump announce say im go "permanently pause migration" to di US from all "third world countries".

E no give details of im plan or name which countries fit dey affected.

Di president also blame refugees for causing di "social dysfunction for America" and e vow to remove "anyone wey no be net asset" to di US.

Im comments dey come one day afta one Afghan national dey face accuse say e shoot two members of di National Guard for Washington DC, one of dem bin die on Thursday, 27 November.

"I go permanently pause migration from all Third World Countries to allow di U.S. system to fully recover, terminate all of di millions of Biden illegal admissions, including those wey Sleepy Joe Biden autopen sign, and remove anyone wey no be net asset to di United States," e tok on im social media platform, Truth Social.

Trump bin previously tok say di shooting highlight a major national security threat and e promise to take steps to remove any foreigner "from any country wey no belong here".

On Wednesday, di US bin suspend processing all immigration requests from Afghans, di govment say dem make di decision pending one review of "security and vetting protocols".

For im latest post on Thursday night, Trump also pledge to "end all federal benefits and subsidies to noncitizens".

Earlier on Thursday, di US Citizenship and Immigration Services tok say dem go re-examine green cards issued to individuals wey immigrate to di US from 19 countries.

Wen BBC ask which countries dey on di list, di agency point to one June proclamation wey di White House issue include; Afghanistan, Cuba, Haiti, Iran, Somalia and Venezuela.

Oda countries wey dia green card holders go undergo dis examination include Burma, Chad, Republic of Congo and Libya.

Di govment no give further details about wetin di re-examination go look like.

Di two announcements dey come afta reports say di suspect for Washington DC shooting enta US for 2021 under one programme wey offer special immigration protections to Afghans for di wake of America withdrawal from Afghanistan.

Officials tok say di suspect Rahmanullah Lakanwa bin once work alongside di CIA for Afghanistan and e help guard US forces for Kabul airport during evacuations, one former military commander wey serve wit am tell BBC Afghan Service.

Who be dis 'Third World Countries' wey Trump dey refer to?

Trump or im officials never provide details of im plan or name which countries fit dey affected.

But Joseph Edlow wey be di Director of di United States Citizenship and Immigration Services bin say based on di direction of Trump, e don direct a full scale, rigorous reexamination of every Green Card for every alien from every country of concern.

So who be dis 'Countries of Concern' and wetin be dia status?

President Donald Trump for June bin sign one executive order wey impose full travel ban on foreign nationals from 12 countries and restrict citizens of seven odas wey e term countries of concern.

Dem be;

  • Afghanistan - Di entry of nationals of Afghanistan as immigrants and nonimmigrants to di US dey fully suspended.
  • Burma - Fully Suspended
  • Chad - Fully suspended
  • Republic of DR Congo - Fully suspended
  • Equatorial Guinea - Fully suspended
  • Eritrea - Fully suspended
  • Haiti - Fully suspended
  • Iran - Suspended
  • Libya - Fully suspended
  • Somalia - Fully suspended
  • Sudan - Fully suspended
  • Yemen - Fully suspended
  • Burundi - Partially suspended
  • Cuba - Partially suspended
  • Laos - Partially suspended
  • Sierra Leone - Partially suspended
  • Togo - Partially suspended
  • Turkmenistan - Partially suspended
  • Venezuela - Partially suspended

Wetin really be 'Third World Countries'?

Di idea of di First, Second and Third World bin come from di Cold War, wen di world bin dey divided between di US-aligned Western Bloc and di communist Eastern Bloc, di neutral nations and di rest dey grouped as di Third World wey often dey used to describe poorer or "underdeveloped" countries.

Di term "Third World" dey outdated. Di United Nations now dey refer to dem as di "Least Developed Countries" (LDCs).

Di UN bin design one specific list of LDCs based on economic and social vulnerability, wey include countries like Afghanistan, Bangladesh, Haiti, and Yemen.

No official UN "Third World" list dey, and di original term now dey considered obsolete and less precise.

Currently, 44 countries dey wey di United Nations list as di least developed countries (LDCs).

32 countries fall under Africa:

  • Angola
  • Benin
  • Burkina Faso
  • Burundi
  • Central African Republic
  • Chad
  • Comoros
  • Democratic Republic of Congo
  • Djibouti
  • Eritrea
  • Ethiopia
  • Gambia
  • Guinea
  • Guinea Bissau
  • Lesotho
  • Liberia
  • Madagascar
  • Malawi
  • Mali
  • Mauritania
  • Mozambique
  • Niger
  • Rwanda
  • Senegal
  • Sierra Leone
  • Somalia
  • South Sudan
  • Sudan
  • Togo
  • Uganda
  • Tanzania
  • Zambia

Eight countries fall under Asia:

  • Afghanistan
  • Bangladesh
  • Cambodia
  • Lao People's Democratic Republic
  • Myanmar
  • Nepal
  • Timor-Leste
  • Yemen

One country for di Caribbean:

  • Haiti

Three countries for di Pacific:

  • Kiribati
  • Solomon Islands
  • Tuvalu

Di list of LDCs dey dey reviewed every three years by one Committee for Development Policy (CDP), wey be a group of independent experts wey dey report to di Economic and Social Council (ECOSOC) of the United Nations.

Di next review dey scheduled for 2027.